1 Kings 14pcm

1Dat time, Jeroboam pikin, Abijah dey sick.

2So Jeroboam tell en wife, “Shange yorsef make pipol nor know who yu bi kon go Shiloh go meet Profet Ahijah wey sey I go bi king for Israel.

3Yu go gi-am ten bread; some kakes and honey. Den ask am wetin go happen to awa pikin and e go tell yu.”

4So di woman go Profet Ahijah house for Shiloh. Profet Ahijah nor dey si again, bikos e don old well-well.

5God don tell am sey Jeroboam wife dey kom ask am about en pikin wey nor well. So God tell Profet Ahijah wetin e go do wen Jeroboam wife kom, even doh di woman dress like anoda pesin.

6As Profet Ahijah hear am dey knock di door, e ansa, “Make yu kom inside, bikos I know sey yu bi Jeroboam wife. So wetin make yu dress like anoda pesin? I get bad news for yu.

7Make yu go tell King Jeroboam, ‘Dis na wetin di Oga wey bi Israel pipol God tok, “I choose yu among evribody kon make yu king for Israel.

8I take di kingdom from David shidren-shidren kon give yu. But yu nor bi like David my savant wey always dey obey and do only wetin I like.

9Yu don sin pass doz wey rule before yu. Yu don rijet and make mi vex, bikos yu make juju and image kon dey serve dem.

10“ ‘ “Bikos of dis, I go skata yor throne kon kill all yor sons and shidren-shidren; both di ones wey don old and di yong ones. I go finish yor family; dem go swip dem komot like dirty.

11Anybody for yor family wey die for inside town, na dogs go chop en dead body and vulture go chop di ones wey die for di open kountry. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”

12So Profet Ahijah tell Jeroboam wife, “Naw, make yu dey go house back and as yu just dey enter di town, yor pikin go die.

13All di pipol for Israel go mourn and beri am. Na only en dem go beri well for Jeroboam family, bikos na only en di Oga wey bi Israel pipol God, dey happy with.

14“God go put king for Israel wey go end Jeroboam throne.

15God go shake Israel land like wood wey dey float for wota. E go rut Israel pipol komot from dis good land wey E give dia grand-grand papa kon skata dem pass Eufrates River, bikos dem don make am vex as dem make Asherah juju kon dey woship am.

16God go abandon Israel pipol, bikos King Jeroboam don make di pipol sin.”

17So King Jeroboam wife kon go back to Tirzah. As e just dey enter en house, en pikin kon die.

18Israel pipol mourn and beri am, just as God tok thru en savant, Profet Ahijah.

19Evry oda tin wey Jeroboam do, di war wey e fight and how e rule, dem rite dem for Israel kings history book.

20Jeroboam rule for twenty-two years. E die and dem beri am. So, Nadab, en pikin kon take-ova as king.

21Rehoboam wey bi Solomon pikin, na forty-one years e bi wen e start to rule Judah and e rule for seventeen years from Jerusalem, di town wey God don choose from all Israel aria, as di place where dem go for dey woship am. King Rehoboam mama name na Naamah wey kom from Ammon.

22Judah pipol sin well-well and dem kon make God vex pass as E vex for dia grand-grand papa.

23Dem build where dem for dey woship yeye gods kon use stones build Asherah juju for evriwhere, on-top di hills and for under evry green trees.

24Di one wey bad pass bi sey, e get some wimen wey dey do ashawo work for doz place wey dem for dey serve juju. Judah pipol do tins wey dey make pesin shame, just as di pipol wey God drive komot for di land before, dey do.

25For di fift year wen Rehoboam dey rule, King Shishak for Egypt kon attack Jerusalem.

26All di good tins wey dey di temple and di gold shield wey Solomon make, di king karry dem go Egypt.

27King Rehoboam make gold shield take replace dem kon put ofisas to guide di palis gate.

28Anytime di king go di temple, di guards go karry di shield kom, den take am go back to di guard-room.

29Evry oda tin wey Rehoboam do, dem rite dem put for Judah king history book.

30Wen King Rehoboam and King Jeroboam dey rule, na so-so fight dem dey fight demsef.

31Wen Rehoboam die, dem beri am for David royal grave for en town. En mama, na Naamah wey kom from Ammon and Rehoboam pikin, Abijah kon take-ova as king.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Kings 14.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.