1 Chronicles 4pcm

1Judah shidren-shidren na: Perez, Hezron, Karmi, Hur and Shobal.

2Na Shobal bi Reaaya papa; Reaaya na Jahat papa; Jahat kon bi Ahumai and Lahad papa and na dem bi Zorah pipol grand-grand papa.

3Etam sons na: Jezrel, Ishma and Idbash. Dia sista name na Hazelelponi.

4Na Penuel bi Gedor papa, while Ezer kon bi Hushah papa. Hur wey bi Efrat first pikin and Betlehem pipol papa, na en shidren-shidren bi dis.

5Ashhur wey bi Tekoa papa marry two wifes; Helah and Naarah.

6Naarah born Ahuzzam, Hefa, Temeni and Haahashtari.

7Helah sef born: Zeret, Zohar, Etnan

8and Koz wey kon bi papa to Anub, Hazzobebah and Aharhel pipol wey Harum born.

9E get one man wey dem dey respet well-well among en brodas and en name na Jabez. En mama koll am Jabez (wey mean pain) bikos e sey, “I sofa well-well wen I won born yu.”

10Jabez kon pray, “Israel God, make Yu bless mi and let my land big well-well. Make yor hand dey with mi kon save mi from trobol, so dat sofa nor go kill mi!” So God kon ansa en prayer.

11Kelub wey bi Shuha broda, na-im bi Mehir papa and na Mehir born Eshton.

12Na Eshton born Bet-Rafa, Paseah and Tehinnah wey bi Ir Nahash papa. All of dem na Rekah men.

13Kenaz born Otniel and Seraya; Otniel born Hatat and Meonotai.

14Na Meonotai bi Ofrah papa and na Seraya born Joab. Na dis Joab born doz pipol wey dey stay and karve wood for Ge-Harashim.

15Kaleb wey Jefunneh born, en sons na: Iru, Elah and Naam. Na Elah bi Kenaz papa.

16Jehallelel sons na: Zif, Zifah, Tiria and Asarel.

17Ezra sons na: Jeta, Mered, Efer and Jalon. Na Eshtemoa wey bi Mered wife born Miriam, Shammai and Ishbah wey bi Eshtemoa papa.

18Mered still marry one woman wey kom from Judah tribe and dem born three sons: Jared wey build Gedor town: Heba wey build Soko town and Jekutiel wey build Zanoah town.

19Hodaya marry Naham sista. Na one among di woman son bi papa to Keilah wey kom from Garm and Eshtemoa wey kom from Maakat.

20Shimon four shidren na: Amnon, Rinnah, Ben-Hanan and Tilon. Ishi shidren-shidren na: Zohet and Ben Zohet.

21Shelah na one among Judah sons and na-im born Er wey Leka papa; Laada wey bi Maresha papa from Bet-Ashbea town where dem for dey make linen;

22Jokim and all di pipol wey dey stay for Kozeba town. E still born Joash and Saraf wey rule for Moab and Jashubi Lehem. (All dis names na from di old rekord book).

23Na dem bi di potta wey stay for Netaim and Gederah dey work for di king.

24Simeon shidren-shidren na: Nemuel, Jamin, Jarib, Zera and Shaul.

25Shaul sons na: Shallum, Mibsam and Mishma.

26Mishma sons na: Hammuel, Zakkur and Shimei.

27Shimei get sixteen sons and six dotas. But en brodas nor born many shidren, so dia family nor many rish Judah sons.

28Simeon shidren-shidren stay for Beersheba, Moladah, Hazar-Shual,

29Bilhah, Ezem, Tolad,

30Betuel, Hormah, Ziklag,

31Bet-Marcabot, Hazar-Susim, Bet-Biri and Shaaraim. Dis na dia towns till David kon bi king.

32Dem still stay for Etam, Ain, Rimmon, Token and five towns for Ashan.

33Dem still stay for all di small-small village wey dey near dis towns go rish Baal. Na where dem stay bi dat and dem rite and keep all dia family history.

34Dia family leaders na: Meshobab, Jamlek, Joshah wey bi Amazaya pikin,

35Joel, Jehu wey bi Joshibaya pikin and na Seraya wey Asiel born bi en grand-papa.

36E still get Elioenai, Jaakobah, Jeshohaya, Asaya, Adiel, Jesimiel, Benaya,

37Ziza wey bi Shipi pikin. Na Allon wey Jedaya born, bi Shipi papa. Shimri born Jedaya and na Shemaya bi Shimri papa.

38Na dis pipol bi di leaders for dia family. Dia family kon dey many more-more.

39Dem go where dem dey take enter Gedor kon even waka rish di east side for di valley, dey find grass make dia animals chop.

40Dem si betta big land, where nobody go for disturb dem, den dem kon give dia sheep grass chop. Some pipol from Ham don dey stay der before dat time.

41Di men wey dem rite dia names before, kom for di time wey Hezekaya bi king for Judah and dem attack and kill Ham and all Meun pipol wey dem si for der, bikos dem si grass wey dia animals go chop.

42Pelataya, Nearaya, Refaaya and Uzziel wey bi Ishi pikin, na dem lead Simeon five hundred men go di hill kountry for Seir,

43where dem for kill Amalek pipol wey run go stay der and dem dey stay der kon rish today.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 4.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.