1 Chronicles 23pcm

1Wen David don old well-well, e kon make en pikin Solomon, king for Israel.

2David gada Israel leaders, di priests and Levi pipol togeda

3kon kount all di men wey kom from Levi tribe wey don rish or pass thirty years and all of dem na, 38,000.

4Di king choose 24,000 wey go do di temple work; 6,000 wey go dey rite and judge kase;

54,000 wey go dey guide and anoda 4,000 wey go dey praiz God with di music instrument wey di king make.

6David divide Levi pipol into three groups, just as dem take kom from Gershon, Kohat and Merari family.

7Gershon born two sons: Ladan and Shimei.

8Ladan three son na: Jehiel, Zetam and Joel.

9Shimei three sons na: Shelomot, Haziel and Haran. Na dem dey lead Ladan family.

10Shimei still born: Jahat, Ziza, Jeush and Beraya.

11Na Jahat dey lead di family sekond to Ziza. Jeush and Beraya nor born many sons, so dem kount dem as one family.

12Kohat born four sons: Amram, Izhar, Hebron and Uzziel.

13Na Amram born Aaron and Moses. Dem choose Aaron and en shidren-shidren to dey kare for di holy tins; burn incense to take woship God; to dey serve God and dey bless di pipol with God name forever.

14But Moses wey bi God savant, dem rite en shidren-shidren name join Levi pipol.

15Moses born two sons: Gershom and Elieza.

16Na Shebuel bi Gershom first son.

17Elieza born only Rehabaya, but Rehabaya born many shidren.

18Na Kohat sekond pikin, Izhar born Shelomit.

19Hebron four sons na: Jeraya, Amaraya, Jahaziel and Jekameam.

20Uzziel sons na: Mikah and Isshaya.

21Merari sons na: Mahli and Mushi. Mahli sons na: Eleazar and Kish.

22But Eleazar nor get boy pikin before e die, na only girls e born. En girl shidren marry Kish shidren wey bi dia kousin.

23Mushi born three sons: Mahli, Eda and Jerimot.

24Na Levi shidren-shidren bi dis, just as dem rite dia name for dia difren family. Doz wey don rish twenty years for Levi family, still follow dem work for God Temple.

25Den David sey, “Di Oga wey bi Israel God don give en pipol rest and E go stay Jerusalem forever.

26So, Levi pipol nor nid to dey karry di tent wey God dey and all di tins wey dem take dey woship am, again.”

27Just as David kommand, dem kon kount Levi pipol wey don rish and pass twenty years.

28Dia work na to help Aaron shidren-shidren as dem dey serve for God Temple. Na dem dey kare for di kourtyard; di rooms; to dey klean di holy tins and any oda tin wey koncern God Temple.

29Na dem still dey kare for di bread wey dey der; di ofrin flour; di bread wey nor get yist; to dey mix dem and all di tins wey dem dey measure.

30Dem still dey stand for one special place evry morning and evening dey offa tanks and praiz to God,

31both for di time wen dem burn sakrifice as ofrin to God on Sabat Day and for New Moon Feast. E get di nomba of pipol wey must serve God evritime, just as dem rite am for di law.

32Na dem dey kare for di tent where dem for dey meet and di holy place. Dem still dey help dia brodas wey bi Aaron shidren-shidren, wey dey serve for God Temple.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Chronicles 23.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.