1Naw, Devil won bring trobol kom meet Israel pipol, so e kon make David kount di pipol.
2David orda Joab and di oda ofisas sey, “Make una go round Israel from one end to di oda for di kountry kon kount all di pipol, bikos I won know how dem many rish.”
3Joab ansa, “God go make Israel pipol many pass di way dem bi naw! But my oga! All di pipol na yor own, wetin make yu won do dis tin kon put di whole kountry for wahala?”
4But David make Joab obey en kommand. So Joab travel round Israel kon kom back to Jerusalem.
5E tell David, “Di men wey fit bi sojas for Israel na 1,100,000 and for Judah, dem bi 470,000.”
6Bikos Joab nor won bin do wetin di king kommand am, e nor kon kount Levi and Benjamin tribe.
7God vex well-well for wetin happen, so E kon ponish Israel.
8David tell God, “Na big sin I don kommit so, bikos I kount di pipol. Abeg make Yu forgive mi, bikos of dis foolish tin wey I do.”
9Den God tell Profet Gad,
10“Go tell David sey I dey gi-am three tins to choose from and na any one wey e choose, I go do.”
11So Profet Gad go meet David kon tell am wetin God tok, den e ask am, “Na wish one yu wont make God do?
12“Three years wey food nor go too dey; or three monts wey una go dey run from una enemy sojas; or three days wey God go attack una with sickness and en angel go bring deat kom dis land? Na wish one yu wont make I tell God?”
13David ansa, “My kase bad well-well, but I nor wont make men ponish mi. Instead make only God ponish mi, bikos E dey sorry for pesin.”
14So God send sickness kom Israel and 70,000 pipol die.
15God send angel go distroy Jerusalem. Leta, E shange en mind kon tell di angel, “Make yu stop! Di one wey yu do, don rish!” Di angel stand near Araunah wey kom from Jebus, farm.
16David si as di angel stand for di centre; hold en swod as e bin won distroy Jerusalem finish.
17So David pray, “My Oga God, na mi do wrong; na mi sey make dem kount pipol. Wetin all dis poor pipol do? Abeg, make Yu leave dis pipol kon ponish mi and my family.”
18Den God angel kon tell Profet Gad, “Kommand David make e go Araunah farm go build altar for God for der.”
19So David obey God kommand and e go build altar for der, just as Profet Gad tell am.
20For di farm, as Araunah and en four shidren dey plant wheat, dem kon si di angel, den all of dem run go hide.
21As Araunah si David dey kom, e bow face groun.
22David kon tell am, “Make yu sell yor farm give mi, I won build altar put for God, so dat dis sickness go stop. I go give yu di money wey yu wont for am.”
23Araunah ansa, “My king! Make yu take am do anytin wey yu wont. Yu still fit take dis animal kon burn am for di altar, den use dis board take do di fire; even wheat dey here for ofrin. I dey give all of dem to yu.”
24But David ansa, “No! I go pay yu for evritin, I nor go fit give wetin bi yor own to God as ofrin. I nor fit give God sometin wey I nor sweat or pay for.”
25So David pay Araunah six hundred gold koins for di farm.
26E build altar for der for God kon do burnt and fellowship ofrin for di altar. E pray and God kon ansa am, bikos E send fire from heaven kon burn di sakrifice for di altar.
27God tell di angel make e remove en swod and e obey.
28David si sey God don ansa en prayer, so e kon still offa sakrifice for di altar wey dey Araunah farm.
29As all dis tins dey happen, di tent wey Moses build for desert and di altar where dem for dey burnt sakrifice put, still dey where dem for dey woship for Gibeon.
30But David nor fit go woship God for der, bikos e dey fear God angel and en swod.