Revelation 7pcm

1Den, I si for angels stand for di for korna for di eart and dem whole di for breeze, so dat e nor go blow for di eart, di sea or for any tree.

2Den I si anoda angel dey kom down from di east. E karry God key, den e kon shaut give doz for angels wey dem don give pawa to ponish land and sea sey,

3“Make una wait! Make una nor ponish di land, sea or di trees, until wi don put God mark for en savants fore head.”

4Den I hear di nomba wey dem put God mark for dia fore head. Dem bi 144,000 from all di tribes for Israel:

5Dem mark 12,000 from Judah tribe, 12,000 from Reuben tribe, 12,000 from Gad tribe.

6And from Asher tribe, na 12,000 dem mark, 12,000 from Naftali tribe, 12,000 from Manasseh tribe,

712,000 from Simeon tribe, 12,000 from Levi tribe, 12,000 from Issakar tribe,

812,000 from Zebulun tribe, 12,000 from Josef tribe and 12,000 from Benjamin tribe.

9Afta all dis tins, I look up kon si crowd wey nobody fit kount. Dem kom from difren tribe, kountry, group, language and dem stand for di throne and di Lamb front. Dem wear white klot kon whole palm tree branches for hand

10dey shaut sey: “Awa God wey sidan for di throne and di Lamb, na yu get pawa to save pipol!”

11And all di angel stand round di throne; di eldas and di four creatures. Dem fall face groun kon bigin woship God.

12Dem kon dey sey: “Make praiz, glory, wisdom, tanks, honor, authority and pawa bi awa God own forever and ever. Amen!”

13Den one for di eldas kon ask mi sey, “Dis pipol wey wear long white klot so, where dem from kom?”

14I kon ansa, “My oga, na yu know di ansa.” Den e sey, “Dis pipol die bikos of Christ. Dem don use di Lamb blood take wosh dia klot, naim make am white like dat!

15Dis na why dem stand for God throne front kon dey serve am for en Temple, both for nite and day time.

16Hongry nor go ever katch dem again. Dem go always get wota to drink; sun nor go ever beat dem again.

17Bikos di Lamb for di throne, go bi dia Shepad. E go take dem go drink from di river wey dey give life. And evry tears wey dey dia eyes, God go klean am komot.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Revelation 7.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.