Revelation 20pcm

1Den I si one angel dey kom down from heaven, e whole di pit key and one big shain.

2E seize di dragon, dat old snake wey bi Satan di devil and dem don tie am der for like 1,000 years.

3Den di angel trow am put for di pit kon lock di door with key, so dat e nor go fit deceive pipol until di 1,000 years don komplete. (Afta dis tins, dem must free am for short time.)

4Den I si thrones and pipol wey God don give authority to judge, sidan on-top di thrones. Doz wey dem kut dia head komot bikos of di trut about Christ and God word, I still si dem too. Dis ones nor woship di beast or en image and dem nor gri make dem put en mark for dia fore head or hand. Dis pipol raiz-up kom life kon rule with Christ for 1,000 years.

5(But di rest pipol wey don die nor go live again, until di 1,000 years don komplete.) Dis na di first resureshon.

6God don bless di holy pipol wey join for di first resureshon! And dis pipol nor go die again, but dem go bi God and Christ priests and dem go rule with am for 1,000 years.

7Wen di 1,000 years don finish, God go free Satan from en prison

8and e go-go deceive pipol for di world; e go bring Gog and Magog togeda kon fight di war and dem go many like san-san for sea.

9Dem go waka round di world and where God pipol dey stay and di town wey evribody love, fire go kom down from heaven kon burn am finish.

10Den, dem go trow di devil wey deceive pipol inside God fire. Den di beast and en fake profets go sofa both day and nite forever and ever.

11Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.

12And I si di pipol wey don die, both big and small, as dem stand for di throne front. Dem open plenty books and den kon open anoda book wey bi di Life Book. And dem judge doz wey don die akordin to wetin dem rite for di books sey dem do.

13And doz wey don die inside sea kon kom out. Deat and grave release di ones wey dey inside dem and God judge dem akordin to wetin dem do.

14Den dem trow deat and grave inside di fire. Dis fire na di sekond deat.

15Anybody wey dem nor si en name inside di Life Book, dem go trowey am inside di big fire.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Revelation 20.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.