Revelation 1
1 Dis vishon na from Christ and na God sey make e show en savants wetin go soon happen. E make am klear thru di angel wey E send kom meet John
2 and John bear witness for evritin wey e si. Dis na wetin John tok koncerning God word and about Jesus Christ.
3 Di pesin wey go read dis profesy give pipol, God go bless am. God go bless doz wey dey listin and do wetin dem rite for di profesy, bikos di time don near.
4 Na John rite dis leta go give di seven church wey dey Asia aria. Make grace and peace dey with una from di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go still kom. From di seven spirits wey dey en throne front
5 and from Jesus Christ, di witness wey dey tok trut; di first-born among doz wey God raiz from deat and naim bi di King of all kings. Christ wey love and free us from awa sins with en own blood;
6 di one wey give us betta kingdom kon make us priest wey go dey serve God wey bi en Papa, make glory and pawa bi en own forever and ever! Amen.
7 (Make una look! E dey kom back inside di kloud and evry eye go si am. Even doz wey shuk am and all di tribes wey dey dis eart, go kry bikos of am. Dis tins go really happen! Amen.)
8 God sey, “Na mi bi di Alfa and Omega, di One wey dey since, wey dey naw and wey go still kom, na mi bi di God Almighty!”
9 Mi John, I bi una broda and I dey follow una share from di trobol bikos of di kingdom and dey bear di sofa wey dey inside Jesus. Dem porshu mi go Patmos Island, bikos I dey prish God word and tok about Jesus Christ.
10 On Sunday, God Spirit kon dey kontrol mi and from my back, I kon hear one loud vois like trumpet dey sey,
11 “Make yu rite evritin wey yu dey si inside dis book, den send dem go meet di pipol wey dey di seven church wey dey for Efesus, Smyrna, Pergamum, Tiatira, Sardis, Filadelfia and Laodicea.”
12 I turn make I si di pesin wey dey tok to mi and wen I turn, I kon si seven lampstand wey dem take gold make.
13 And di pesin wey stand for di lampstand centre, bi like Man Pikin. E wear long dress with gold belt for en waist.
14 En head and hair white like wool, dem even white rish snow and en eyes red like fire wey dey burn well-well.
15 En legs bi like bronze wey dem polish for fire and en vois bi like di nois wey sea dey make.
16 E whole seven stars for en rite hand and swod wey get two sharp side, dey kom out from en mout. En face dey shine like sun.
17 Wen I si am, I fall near en leg like sey I don die. But E tosh mi with en rite hand, kon sey: “Nor fear! Na mi bi di First and di Last,
18 di One wey dey alive! I die before, but naw, I dey alive forever and ever. Deat and grave key dey my hand.
19 So make yu rite wetin yu si: both doz wey go happen naw and di ones wey go happen leta.
20 Di seven stars wey yu si for my rite hand, na dia sekret bi dis: Di stars na di angels for di seven church and di seven lampstand, na di seven church.”