1God na king and en glory wey dey shine well-well, kover evriwhere. True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa. Di world stand gidigba and nor-tin fit shake am.
2My God, yor throne don dey even before Yu kreate di world. Yu yorsef, don dey forever and ever.
3My Oga God, even doh rivers dey full and make nois like tonda as dem dey go up-and-down,
4Yu wey dey up, strong pass di waves and river wey dey rush with speed. God get pawa pass all dis tins!
5My God! Nobody fit shange yor laws! Yor kingdom dey holy and Yu go rule forever and ever.