Bible

Say Goodbye

To Clunky Software & Sunday Tech Stress!

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 93

:
Nigerian - pcm
1 God na king and en glory wey dey shine well-well, kover evriwhere. True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa. Di world stand gidigba and nor-tin fit shake am.
2 My God, yor throne don dey even before Yu kreate di world. Yu yorsef, don dey forever and ever.
3 My Oga God, even doh rivers dey full and make nois like tonda as dem dey go up-and-down,
4 Yu wey dey up, strong pass di waves and river wey dey rush with speed. God get pawa pass all dis tins!
5 My God! Nobody fit shange yor laws! Yor kingdom dey holy and Yu go rule forever and ever.