Psalms 87pcm

1Di town wey God build by ensef, dey for di holy mountin.

2God love Jerusalem pass any oda town for Israel.

3Si as pipol dey tok good tins about yu Jerusalem wey bi God town!

4I go kount Egypt and Babilon join di towns wey know mi. I go still kount Filistia and Tyre plus Ethiopia town join dem. All of dem dey sey dem born dem for Jerusalem!

5But for Jerusalem real pipol, odas go sey, “Una dey enjoy o-o, bikos una bi Jerusalem pipol.” And di Most High God go bless di town by ensef.

6Wen God dey kount and rite en pipol name for en book, E go sey, “Dem born dis ones sef for Jerusalem.”

7So di pipol go blow trumpet kon sing sey, “Na Jerusalem bi di hope wey wi get!”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 87.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.