Bible

Elevate

Your Sunday Morning Worship Service

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 87

:
Nigerian - pcm
1 Di town wey God build by ensef, dey for di holy mountin.
2 God love Jerusalem pass any oda town for Israel.
3 Si as pipol dey tok good tins about yu Jerusalem wey bi God town!
4 I go kount Egypt and Babilon join di towns wey know mi. I go still kount Filistia and Tyre plus Ethiopia town join dem. All of dem dey sey dem born dem for Jerusalem!
5 But for Jerusalem real pipol, odas go sey, “Una dey enjoy o-o, bikos una bi Jerusalem pipol.” And di Most High God go bless di town by ensef.
6 Wen God dey kount and rite en pipol name for en book, E go sey, “Dem born dis ones sef for Jerusalem.”
7 So di pipol go blow trumpet kon sing sey, “Na Jerusalem bi di hope wey wi get!”