1My God, Yu don pour blessing and favor put for yor land and give Israel en glory back.
2Yu forgive yor pipol dia sins. Yes! Yu kover all dia sins.
3Yu nor dey vex for dem again and Yu nor show dem yor vexnashon.
4My God wey dey diliver us, make Yu save us again! Make Yu nor dey vex for us!
5Abi Yu go dey vex for us forever? Yu go just dey vex even for awa shidren-shidren?
6Yu nor go revive us again so dat yor pipol go happy bikos of Yu?
7My God, make Yu show us yor loyal love! Pour yor salvashon for awa head!
8I go listin to wetin Oga God tok, bikos E go make peace with en pipol; doz wey dey obey am, so-far dem nor go-go back to dia wiked and yeye ways.
9True-true, time dey kom wen pipol wey dey follow am well, go si en salvashon; den en glory go appear for di land again.
10Love wey nor dey fail and trut, don join togeda. Raitiousness and peace don kiss each oda.
11Trut dey kom out from di world and raitiousness dey smile kom down from heaven.
12Yes, God dey pour en blessings kom down, so awa land go produce betta-betta food again.
13Raitiousness dey go for God front go prepare di way wey E go pass.