Bible

Create

Inspiring Presentations Without Hassle

Try Risen Media.io Today!

Click Here

Psalms 43

:
Nigerian - pcm
1 My God, make Yu show sey I dey innocent! Save mi from pipol wey nor dey fear Yu. Diliver mi from doz wey dey lie,
2 bikos na Yu bi di God wey dey save mi. But wetin make Yu rijet mi? Why I go dey waka with pains, bikos my enemies dey opress mi?
3 Make Yu send yor lite and trut kon guide mi. Make dem karry mi go yor holy mountin, di place wey Yu dey stay.
4 For der, I go-go God altar; di God wey dey give mi joy kon praiz am with my harp!
5 Wetin make my soul dey weak? Wetin make my heart nor happy at-all? But I go put my hope for God hand! I go praiz am again, bikos na-im bi my Savior and God!