Psalms 26pcm

1My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent.

2O my God, make Yu look mi well-well, den test my heart, so dat Yu go know wetin I dey tink.

3Bikos I dey sure about yor love wey nor dey fail and I dey live my life, just as Yu sey make I leave am.

4I nor get time to spend with lie-lie pipol or waka with dem.

5I hate to dey where bad pipol dey and I nor go ever follow wiked pipol waka.

6My God, I dey live my life well, so dat I go fit kom yor altar

7kom tank and tell Yu about all di wonderful tins wey Yu don do.

8Oga God, I love yor temple; di place where Yu dey and where yor glory for dey shine.

9Make Yu nor let mi sofa with my enemies and nor kill mi with wiked pipol.

10Dia hands dirty with di wiked tins wey dem don do and dem dey always take bribe.

11But I nor bi like dat; I dey live betta life. So, make Yu kom save and sorry for mi.

12Naw, I dey save and I don join di pipol wey dey woship Yu, so I go praiz my God.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 26.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.