Psalms 144pcm

1I go praiz God wey bi my rock, bikos na-im dey protet mi. Na-im train my hand for war kon give mi pawa to fight.

2E love mi and E dey protet mi. Na inside am I dey hide put and na-im bi di Pesin wey dey diliver mi. Na-im dey kover mi and di Pesin wey dey save mi. Na God dey make pipol obey mi.

3My God, na who wi bi wey Yu dey kare for us like dis? Na ordinary human being Yu dey kare for so?

4Wi just bi like air wey dem dey breath; awa days bi like shadow wey dey fade go.

5Oga God, make Yu open di heavens kon kom down. Make Yu tosh di mountins, so dat smoke go kom out.

6Make Yu shine yor lite kon skata yor enemies! Make Yu shot yor arrow kon konfuse dem!

7Kom down from heaven make Yu save mi; kom save mi from di deep wota and from my enemies pawa.

8Na lie-lie full dia mout; dem swear sey dem go tok di trut, but na lie dem just dey lie.

9My God, I go sing new song to Yu! I go use jita wey get ten rope take sing and praiz Yu.

10Bikos Yu don give yor kings viktory kon save yor savant David from en enemies swod.

11Save and diliver mi from my enemies pawa, bikos na lie-lie full dia mout and even doh dem swear sey dem go tok trut, na lie dem still dey tok.

12Make awa sons prosper for dia yong age like betta plant wey dem put fertaliza. Make awa dotas bi like betta pila wey dem karve for palis.

13Make difren-difren food full awa store house. Make di animals wey dey awa land dey plenty more-more.

14Make awa melu karry many propaty as dem dey kom. Make no enemy break enter awa wall kon katch us and make peace dey awa town.

15Yes! Di pipol wey dis kind tin dey happen to, go happy! True-true, doz wey God bi dia God, go happy well-well.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 144.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.