Bible

Elevate

Your Sunday Morning Worship Service

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 1

:
Nigerian - pcm
1 God go bless di pesin wey nor dey follow wiked pipol advise, dey waka with sinnas or sidan with aproko pipol!
2 Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem.
3 E bi like tree wey dem plant near wota; wey dey bear fruit for di korrect time and en leaf nor dey dry. E dey prosper for anytin wey e do.
4 But nor bi so e bi for wiked pipol! Instead, dem bi like leaf wey breeze blow trowey.
5 Bikos of dis, wiked pipol nor go fit stand for Judgement Day and sinnas nor go fit dey for where God pipol gada put.
6 True-true, God dey guide en pipol for evritin wey dem dey do, but E go distroy doz wey nor dey follow en ways.