Proverbs 9pcm

1Wisdom don build en house with seven pilas.

2E don kill animals to take do party, mix spice for inside di wine kon put am for di tabol.

3E send en savant go announce on-top di mountin for di town sey:

4“Pipol wey nor know anytin, make una kom inside!” Den e tell doz wey foolish sey,

5“Make una kom chop my food and drink di wine wey I mix.

6Make una komot from where fools dey and una go get life. Make una kom follow wisdom waka.”

7If yu korrect proud pipol, dem go curse yu! Anybody wey try to tok to wiked pipol, dem go still curse am.

8So, nor ever korrect proud pipol, bikos dem go hate yu; but if yu korrect wise pesin, e go respet yu forever.

9Anytin yu tell wise pesin go make am wise more-more. Anytin yu tell raitious pipol go give dem undastandin.

10If yu won get wisdom, yu go first fear God. If yu know di One wey dey holy, den yu don get undastandin.

11Wisdom go add more years to yor age.

12Na yu go gain if yu get wisdom, so even if yu rijet am, na yu go still sofa am.

13Foolishness bi like woman wey nor know anytin at-all, nor get shame at-all and wey dey tok anyhow.

14Di woman go sidan for front of en house or for chair for di side wey high pass for di town

15kon dey koll pipol wey dey waka pass; pipol wey dey mind dia own business sey,

16“Pipol wey nor get sense, make una kom inside!” Den e go tell foolish pipol,

17“Wota wey dem tif dey sweet well-well and bread wey dem tif chop, get betta taste.”

18Doz wey fall for en trap nor know sey, anybody wey enter en house go die and doz wey don already enter don die since.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Proverbs 9.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.