1Na di words wey King Lemuel mama tish am, bi dis.
2My pikin wey I born; my son wey I dedikate give God,
3make yu nor waste yor strent dey follow wimen; bikos dem dey distroy kings.
4Lemuel, my pikin! E nor good make king dey drink wine and make rulers too, nor dey take strong drink.
5Bikos wen dem drink, dem fit forget di laws kon dey opress poor pipol.
6Strong drink na for pipol wey dey won die and wine na for doz wey dia heart heavy.
7So allow dem drink forget dia poverty and dem nor go remember dia trobol again.
8Make yu tok for doz wey nor fit tok for demsef; make yu judge well for doz wey dem dey opress.
9Yes! Tok well for doz wey dem dey opress and for poor pipol, den make sure sey dem give dem korrect judgement.
10Who go fit find wife wey get good karata? Good wife betta pass gold.
11En husband go trust am, bikos di wife go support am for evritin wey e dey do.
12Na only good tins e go bring for en husband evritime and bad tins nor dey join.
13E dey always dey do business; e dey make wool and linen klot.
14E bi like ship for river, wey dey karry food kom from far place.
15E dey kwik wake-up for morning to make food for en family kon tell en savants wetin dem go do.
16E go-go look land kon buy am and e go use di money wey e get, take plant tins for der.
17E get pawa, dey strong and dey work hard.
18E know di value for evritin wey e dey make and e dey work go rish nite.
19Na only en dey use tread and nidol take sew en own klot.
20E dey always give tins to poor pipol and to doz wey know get at-all.
21E nor dey worry if kold dey, bikos en family get klot wey go make dem warm.
22Na en dey make en own bed shit and e dey wear fine klot wey dem make with purpol linen.
23Pipol know en husband well-well and dem dey respet am, bikos e dey sidan with di oda eldas, dey take decision.
24E dey make klot and belt kon sell dem give tradas.
25E dey strong; dem dey respet am and e nor dey fear wetin go happen for future.
26E dey tok with betta sense and wisdom full en mout.
27E always dey busy and e dey make sure sey evritin go well for en family.
28En shidren value am and dem dey tank en and en husband. Dem dey always praiz am.
29En husband go sey, “Many wimen na good wifes to dia husband, but yu betta pass all of dem.”
30Gold dey deceive pipol and beauti dey disappear, but make pipol praiz woman wey dey honor and fear God.
31Make una reward am for evritin wey e dey do and evribody must praiz am for di town.