Proverbs 22pcm

1If yu nid to choose between good name and plenty propaty, make yu choose good name, bikos respet betta pass silva and gold.

2Pesin wey get plenty money and pesin wey nor get, na di same dem bi, bikos na God kreate two of dem.

3Wise pipol dey si trobol dey run, but foolish pipol go run enter kon sofa pain.

4If yu obey God kon honbol yorsef, yu go get propaty, honor and long life.

5Trobol and wahala dey where wiked pipol dey waka pass, but wise pipol wey sabi guide dia soul, dey-dey far from dem.

6Make yu tish yor pikin how e go take live en life and wen e don old, e go still dey do di same tin.

7Na rish pipol dey rule poor pipol and if yu borrow money from pesin, yu go bi en savant.

8Pesin wey like wikedness, na trobol go bi en own and en wahala against oda pipol, go soon end.

9Do good and share yor food with poor pipol, den God go bless yu.

10If una porshu proud pipol komot from where una dey, kworel, wahala and bad words, nor go dey again.

11Pesin wey get klean heart and always dey tok well, di king go always bi en friend.

12God dey protet doz wey dey tok trut, but doz wey dey lie waka, E dey distroy dia plans.

13Lazy pipol dey always sey, “Lion dey outside and e go kill us”, so dem nor go gri go out.

14Pesin wife wey dey sleep with oda men, dey get sweet mout and doz wey God dey vex for, dey fall enter di woman trap

15Shidren nor dey know sey di way dem dey bihave nor good, but betta korreshon go tish dem how to bihave well.

16If yu dey give rish pipol gift kon dey opress poor pipol make yu for get more money, yu go poor too.

17Make yu listin and I go tish yu wetin wise pipol tok and as yu undastand wetin dem tok,

18yu go happy, if yu remember and use dem well.

19I go tell yu evritin naw, bikos I wont make yu trust God.

20I don rite thirty words wey go give yu wisdom, betta advise and

21tish yu wetin trut really mean. So if dem send yu go find am, yu go bring korrect ansa kom back.

22Make yu nor trit poor pipol anyhow bikos yu get pawa! Doz wey nor get help for kourt, make yu nor trit dem anyhow too,

23bikos God go judge dia kase for dem kon ponish doz wey dey treaten dia life.

24Make yu nor make friend with pipol wey get hot and bad tempa,

25bikos if yu learn dia behaviour, yu nor go fit shange again.

26Make yu nor promise to pay money wey anoda pesin dey owe,

27bikos if yu nor fit pay, dem go kon karry yor bed go.

28Make yu nor remove di old boundary stone wey yor grand-grand papa dem take mark where dia land for end.

29Yu don si pesin wey get good work? E dey-dey with kings and nor bi with yeye pipol.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Proverbs 22.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.