Obadiah 1
1 Dis na di vishon wey God give Obadaya about Edom pipol. God send en savant kom di nashons and dem hear di message wey God give dem sey: “Make una ready! Make una gada una sojas go fight Edom pipol!”
2 God tell Edom pipol, “Make una si! I go make una pipol weak and small well-well among all di nashons and pipol go hate una!
3 Una pride don deceive una, bikos una dey stay under rock where una dey save kon build big house on-top mountin. So una dey boast sey, ‘Na who go fit kon meet and attack us for der?’
4 But even if una fly like eagle or build una house among di stars, I go bring una kom down!” Na so mi, God, tok.
5 “Wen tif kom rob yu for yor house for nite, dem go only tif wetin dem wont! Wen pipol go plok grape for dia vineyard, dem dey leave some for poor pipol! But una enemies go distroy una finish!
6 Dem go tif evritin wey dey for Edom land! Even di ones wey dem hide, dem go look for dem kon karry dem go!
7 Doz wey dey help una go turn against una. Dem go help una enemies porshu una komot from una land. Even doh dem dey plan to deceive and distroy una, dem go promise una peace. Una friends wey una trust pass, go set trap for una and una nor go even know.
8 For dat time, one singol wise pesin nor go dey for Edom land again. Bikos on-top Edom mountin, na der I go for distroy all doz wey get sense.” Na so mi, God, tok.
9 “Doz strong sojas from Teman go fear and dem go kill evribody wey dey Edom mountin.”
10 “Bikos una use wikedness take kill una brodas for Israel, na shame and distroshon go follow una forever.
11 Wen dia enemies dey attack dem, una stand dey look and nor gri help dem. Strenjas attack and karry all dia propaty kon trow dice take divide Jerusalem, but una bihave like sey Israel na una enemy.
12 Una nor for dey happy wen dem karry una brodas as slaves go anoda land. Una nor for happy at-all wen Judah pipol dey sofa all dis tins. Una nor for tok anyhow for dat time wey Israel dey sofa.
13 Una nor for enter my pipol town wen dem dey face wahala kon tif dia propaty. Una nor for join dey tok anyhow wen my pipol dey sofa. Una nor for go tif my pipol propaty wen una si sey dem dey weak.
14 Una nor for stand for road dey kill doz una brodas wey dey try to eskape and una nor for katch dia pipol wey run as dem dey sofa.
15 “God Judgement dey kom for all di nashons! Just as una do to Israel, na so too dem go do una. All una evil works go fall for una own head.
16 Just as una swallow my pipol for my holy mountin, na so too una and di oda nashons go swallow di ponishment wey I go give una. Una go drink kon stagga until una disappear komot from dis eart.
17 “But doz wey eskape, go dey Mount Zion and e go dey holy again. Israel pipol go kom back kon take all dia propaty.
18 Jakob shidren-shidren go bi fire; Josef shidren-shidren go bi big smoke and Esau pipol go bi like leaf wey fall for groun, dem go burn dem rish groun, bikos God don tok!
19 Den my pipol wey dey Negev go kollect Esau mountin. Doz wey dey stay near di hill for Judah go take di betta land wey dey Filistia, Efraim and Samaria. Den Benjamin pipol go take Gilead land.
20 Doz wey dem katch for Israel before, go kom back kon stay for Foenicia wotaside wey dey nort for Zarefat. Jerusalem pipol wey dem katch and karry go nort go kom back to dia house for Negev.
21 Doz wey dem save, go-go Mount Zion for Jerusalem kon rule all di mountins for Edom and Oga God go bi dia king!”