Numbers 8pcm

1God kon tell Moses:

2“Go tell Aaron sey make e put di seven lamp for where di lite go for dey shine for di lampstand front.”

3So Aaron do as dem tell am. E put di lamp for di lampstand front, just as God kommand Moses.

4Dis na how dem take make di lampstand: from di top go rish bottom, dem make am with gold, just as God show Moses.

5God tell Moses:

6“Make yu take Levi pipol komot for where Israel pipol dey kon wosh dem, so dat dem go dey holy.

7Dis na how yu go take make dem holy: Sprinkol di holy wota for dia body, den tell dem sey make dem shave di hair for dia whole body kon wosh dia klot, so dat dem go dey holy.

8Dem go take one small melu with korn ofrin wey bi fine flower wey dem mix with olive oil; den yu go take anoda small melu for di holy ofrin.

9Yu go take Levi pipol kom di tent where dem for dey do meetin kon gada all di kommunity for Israel.

10Yu go take Levi pipol kom where God dey and Israel pipol go put dia hand for Levi pipol head;

11den Aaron go offa Levi pipol to God as special ofrin from Israel, so dat dem go do God work.

12“Levi pipol go put dia hand on-top di two melu head; dem go give one as ofrin to klean demsef and di oda one as burnt ofrin, so dat dem go dey holy.

13Yu go offa Levi pipol to God and Aaron and en sons go kare for dem.

14So yu go separate Levi pipol from di oda pipol for Israel and Levi pipol go kon bi my own.

15“Afta dis, Levi pipol go-go do my work for di tent wey dem for dey do meetin. So yu must klean and give dem to God as special ofrin.

16I don use dem take replace all di first-born for Israel and dem bi my own forever.

17Wen I kill all di first-born wey dey Egypt, I make all di first sons and animal for Israel holy, so dat dem go bi my own.

18So I don use Levi pipol replace all di first-born sons for Israel.

19From among Israel pipol, I don give Levi pipol as gift to Aaron and en sons, so dat dem go do di work wey Israel pipol suppose do for di tent where dem for dey do meetin and dem go guide Israel pipol from di wahala wey go happen if dem go near di sanctuary.”

20So Moses, Aaron and Israel pipol kon offa Levi pipol, just as God kommand.

21Levi pipol go klean and wosh dia klot, den Aaron give dem as special gift to God. E still do di sakrifice to make dem holy.

22Di pipol do all di tins wey God kommand Moses about Levi pipol. So Levi pipol kon dey do di work for di tent where dem for dey do meetin and na Aaron and en sons, bi dia oga.

23God tell Moses,

24“From doz wey bi twenty-five years go among Levi pipol, na dem go do God work for di tent where dem for dey do meetin

25and dem go ritaya wen dem don rish fifty years.

26Dem fit help dia brodas for di work; dey give dem wetin dem wont, but make dem nor do any work. Dis na wetin yu go tell Levi pipol to do koncerning dia work for di sanctuary.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Numbers 8.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.