Numbers 1pcm

1God kon tell Moses for di place where dem for dey do meetin for Sinai Wildaness, for di first day, for di sekond mont for di sekond year, afta dem don komot from Egypt:

2“Make yu kount Israel pipol akordin to dia family and tribes, den yu go rite all di men names.

3Make yu and Aaron go nomba all di men for Israel wey bi from twenty years or old pass like dat wey go fit fight war.

4Make una take one man from each tribe and e must bi oga for en family, so dat dem go help una.

16Na dis ones dem choose from di kommunity, as leaders from dia grand-grand papa tribe. Na dem bi oga for all di pipol wey dey Israel.

17So Moses and Aaron take all di men wey dem koll dia name

18kon gada all di pipol for di first day for di sekond mont. Den dem register di pipol akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so. Dem kount all of dem by names,

19just as God kommand Moses and na so e take nomba dem for Sinai Wildaness.

44Dis na di men wey Moses and Aaron kount plus di twelf leaders wey dey Israel, each of dem kom from dia own family.

45All di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so for Israel wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names akordin to dia tribe and family,

46na 603,550.

47But dem nor kount Levi pipol join di oda tribes,

48bikos God tell Moses sey,

49“Make yu nor kount Levi tribe join di oda tribes for Israel.

50But make yu put Levi pipol to look, kare and dey near di Tabanako and evritin wey dey inside.

51Anytime wen dem won move di Tabanako, Levi pipol must take am go down and anytime wen dem won arrange di Tabanako again, na Levi pipol go karry am up. Anybody wey nor bi Levi wey go near am, dem must kill-am.

52So make Israel pipol kamp akordin to di way dem divide dem and each man go dey en own group akordin to en family name.

53But Levi pipol go kamp near di Tabanako to guide am, so dat nobody go-go near am kon make God strike Israel pipol.”

54Israel pipol do all di tins wey God kommand dem thru Moses.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Numbers 1.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.