Bible

Create

Inspiring Presentations Without Hassle

Try Risen Media.io Today!

Click Here

Numbers 1

:
Nigerian - pcm
1 God kon tell Moses for di place where dem for dey do meetin for Sinai Wildaness, for di first day, for di sekond mont for di sekond year, afta dem don komot from Egypt:
2 “Make yu kount Israel pipol akordin to dia family and tribes, den yu go rite all di men names.
3 Make yu and Aaron go nomba all di men for Israel wey bi from twenty years or old pass like dat wey go fit fight war.
4 Make una take one man from each tribe and e must bi oga for en family, so dat dem go help una.
16 Na dis ones dem choose from di kommunity, as leaders from dia grand-grand papa tribe. Na dem bi oga for all di pipol wey dey Israel.
17 So Moses and Aaron take all di men wey dem koll dia name
18 kon gada all di pipol for di first day for di sekond mont. Den dem register di pipol akordin to dia tribe and family; di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so. Dem kount all of dem by names,
19 just as God kommand Moses and na so e take nomba dem for Sinai Wildaness.
44 Dis na di men wey Moses and Aaron kount plus di twelf leaders wey dey Israel, each of dem kom from dia own family.
45 All di men wey don rish twenty years and di ones wey old pass so for Israel wey go fit work as sojas and dem kount dem by dia names akordin to dia tribe and family,
46 na 603,550.
47 But dem nor kount Levi pipol join di oda tribes,
48 bikos God tell Moses sey,
49 “Make yu nor kount Levi tribe join di oda tribes for Israel.
50 But make yu put Levi pipol to look, kare and dey near di Tabanako and evritin wey dey inside.
51 Anytime wen dem won move di Tabanako, Levi pipol must take am go down and anytime wen dem won arrange di Tabanako again, na Levi pipol go karry am up. Anybody wey nor bi Levi wey go near am, dem must kill-am.
52 So make Israel pipol kamp akordin to di way dem divide dem and each man go dey en own group akordin to en family name.
53 But Levi pipol go kamp near di Tabanako to guide am, so dat nobody go-go near am kon make God strike Israel pipol.”
54 Israel pipol do all di tins wey God kommand dem thru Moses.