Nehemiah 11pcm

1Di pipol leaders kon dey stay for di holy town for Jerusalem and if dem divide di pipol for Judah and Benjamin town into ten, na one part dey stay der, while di rest dey stay where dem dey before.

2Di pipol tank di ones wey sey dem go stay for Jerusalem.

3Dis na di ofisas wey kom stay Jerusalem. (Some of di pipol, Levi pipol, priests, temple savants and Solomon savants shidren-shidren still dey stay dia own house for di difren towns wey dey Judah,

4but some among di pipol for Judah and Benjamin go back to Jerusalem, na dem bi.) From Judah tribe: Uzzaya wey Zekaraya pikin Ataya born and na Amaraya born Zekaraya. Na Shefataya wey Perez pikin Mahalalel born, bi Amaraya papa.

5Wi still get Maaseaya wey bi Baruk pikin and na Kol-Hozeh wey Hazaya born, bi Baruk papa. Hazaya na Adaya pikin wey Joiarib born and na Zekaraya wey Shelah born, bi Joiarib papa.

6Perez shidren-shidren wey dey for Jerusalem na 468 and all of dem na betta men.

7From Benjamin tribe: Wi get Sallu wey Meshullam born, wey Joed born, wey Pedaaya born, wey Kolaya born, wey Maaseaya born, wey Itiel born, wey Jeshaya born.

8Pipol wey follow am na Gabbai and Sallai and dia family na 928.

9Na Joel wey Zikri born bi dia oga and na Hassenuah pikin, Judah bi next afta am for di town.

10From di priest: Wi get Jedaya wey bi Joiarib pikin and Jakin

11and Seraya wey Meshullam pikin, Hilkaya born. En grand-papa dem na Zadok, Meraiot and Ahitub wey dey guide God Temple.

12Wi still get 822 pipol wey dey work with am for di temple. Wi get Adaya wey Jeroham born, wey Pelalaya born, wey Amzi born, wey Zekaraya born, wey Pashhur born, wey Malkijah born

13with 242 pipol wey bi head for dia family. Wi still get Amashsai wey Azarel born, wey Ahzai born, wey Meshillemot born, wey Imma born

14and 128 of en strong men follow am. Di pesin wey dey lead dem na Zabdiel wey Haggedolim born.

15From Levi tribe: Wi get Shemaya wey Hasshub born, wey Azrikam born, wey Hashabaya born, wey Bunni born.

16Wi still get Shabbetai wey Jozabad born, wey bi oga for di work wey dem dey do outside God Temple.

17Wi still get Matanaya wey Mikah born, wey Zabdi, Asaf pikin born and na-im dey lead di tanksgivin and prayer. E still get Bakbukaya wey dey support Matanaya and Abda wey Shammua born, wey Galal born, wey Jedutun born.

18All di Levi pipol for di holy town na 284.

19Among doz wey dey guide di gate: E get Akkub, Talmon and 172 pipol.

20God priests, Levi pipol and di rest pipol for Israel dey stay where dia family land dey for Judah.

21But doz wey dey serve for di temple dey stay for Ofel Hill and dia leaders na Ziha and Gishpa.

22Di main Levi pipol oga for Jerusalem na Uzzi wey Bani born, wey Hashabaya born, wey Matanaya born, wey Mikah wey bi Asaf grand-pikin born and na en family dey sing for God Temple.

23Dem dey do evritin as e suppose bi evriday, just as dem rite am for di royal kommand wey dem dey follow.

24Petahaya wey Meshezabel born wey dey among Zera shidren-shidren from Judah tribe, na-im dey advise di king for all di matter wey koncern how to rule and kontrol di pipol.

25But for di village around dia fields, some among di pipol for Judah dey stay Kiriat-Arba, Dibon and Jekabzeel with di place and village wey dey der.

26Dem still dey stay for Jeshua, Moladah, Bet-Pelet,

27Hazar-Shual, Beersheba and di village for

28Ziklag, Mekona and dia village.

29Dem still dey stay En-Rimmon, Zorah, Jarmut,

30Zanoah and Adullam with di village wey dey der. Dem still dey Lakish with di field wey dey near der and Azeka with en village. So Judah pipol stay from Beersheba go di sout valley for Ben-Hinnom.

31Some pipol from Benjamin tribe dey stay for Gibeah, Mikmash, Aija and Bethel with di arias for der.

32Dem still dey stay for Anatot, Nob, Ananaya,

33Hazor, Rama, Gittaim,

34Hadid, Zeboim, Neballat,

35Lod, Ono and Wise Men Valley.

36So, dem send some among Levi pipol wey dey Judah go join Benjamin pipol.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Nehemiah 11.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.