Bible

Power Up

Your Services with User-Friendly Software

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Leviticus 1

:
Nigerian - pcm
1 God koll Moses kon tell am from di Tabanako sey:
2 “Make yu go tell Israel pipol sey, ‘Wen anybody one sakrifice animal give God, e fit use en kattle, sheep or goat.
3 ‘If na burnt ofrin from en animals, e must bring man own wey dey okay kom Tabanako, so dat God go asept am.
4 E go put en hand for di animal head and God go asept am as sakrifice to take forgive en sin.’
5 Den e go kill di animal for der and di priests wey bi Aaron sons go give God di blood kon put am for di four side for di altar wey dey for di tent gate.
6 Den di pesin wey dey give di ofrin go remove di animal skin kon kut am small-small
7 and di priests go arrange and lite firewood near di altar.
8 Dem go put all di animal part for inside, plus di head and di fat.
9 Di man wey dey give di ofrin must wosh di animal intestine and legs and di priest go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.
10 ‘If di man dey give one sheep or goat, e must bi man own wey dey okay.
11 E go kill-am for di nort side for di altar and di priest go put di animal blood for di four side for di altar.
12 Afta di man don kut am small-small, di priest go kon put all di animal part, plus en head and fat for fire.
13 Di man wey dey give di ofrin must wosh di animal intestine and legs, den di priest go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.
14 ‘If di man one give bird as burnt ofrin, e must bi dove or pijin.
15 Di priest must offa am for di altar, e go twist en neck kon burn en head for di altar. E go remove di blood kon put am for di altar side.
16 E go remove di intestine and all di tins wey dey inside kon trowey dem for di east side for di altar where dem dey put di ashes.
17 E go hold di feada kon tear di body open. E nor go allow di feada fall komot, den e go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.