Lamentations 5pcm

1Awa God, make Yu tink about dis tins wey dey happen to us naw and how awa enemies don disgrace us rish.

2Strenjas don take all wetin wi get and na dem dey stay for awa town naw.

3Wi don turn shidren wey nor get papa and awa mama don turn who en husband don die.

4Wi must pay money to drink awa own wota and buy awa own firewood too.

5Dem really dey porshu us and naw, wi don taya, but wi nor fit rest at-all.

6Wi don make agriment with Egypt and Assyria pipol, so dat wi go get enough food to chop make honga nor for kill us.

7Na awa grand-grand papa dem sin and dem don die, but naw, wi dey sofa dia ponishment.

8Doz wey bi awa slave before, don turn awa oga naw and nobody dey to save us from dia pawa.

9Wi dey risk awa life as wi dey find food wey wi go chop, bikos tif many for di towns and di village dem.

10Awa skin hot like oven and na honga make us dey sick so.

11Enemies don rape awa wifes for Jerusalem and dem don disgrace awa yong girls for Judah town.

12Dem hang and kill di kings family kon trit awa eldas anyhow.

13Dem karry awa yong men go do strong work and awa boys dey stagga, bikos of di heavy wood wey dem dey karry.

14Awa eldas nor fit sidan for di town gate again and di yong men nor dey dance and sing again.

15Joy nor dey awa heart again bikos wi wey bin sabi dance, don turn who dey mourn naw.

16Awa crown don fall komot from awa head, bikos wi don sin and naw, wi dey sofa.

17Bikos of dis, wi dey feel pain and wi nor dey si well again; awa eyes don dey weak, bikos wi don kry taya.

18Mount Zion don empty and nobody dey der again, so naw, na wild animals dey stay der.

19So Yu my Oga God, go rule forever and ever! Yor throne go dey from one generashon go rish anoda one.

20But why Yu forget us like dis and wetin make Yu leave us since?

21My Oga God, make Yu save and take us back as yor own! Make Yu give us di happiness wey wi get before.

22Abi Yu don rijet us forever? Yu go kontinue to dey vex for us?

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Lamentations 5.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.