Lamentations 5
1 Awa God, make Yu tink about dis tins wey dey happen to us naw and how awa enemies don disgrace us rish.
2 Strenjas don take all wetin wi get and na dem dey stay for awa town naw.
3 Wi don turn shidren wey nor get papa and awa mama don turn who en husband don die.
4 Wi must pay money to drink awa own wota and buy awa own firewood too.
5 Dem really dey porshu us and naw, wi don taya, but wi nor fit rest at-all.
6 Wi don make agriment with Egypt and Assyria pipol, so dat wi go get enough food to chop make honga nor for kill us.
7 Na awa grand-grand papa dem sin and dem don die, but naw, wi dey sofa dia ponishment.
8 Doz wey bi awa slave before, don turn awa oga naw and nobody dey to save us from dia pawa.
9 Wi dey risk awa life as wi dey find food wey wi go chop, bikos tif many for di towns and di village dem.
10 Awa skin hot like oven and na honga make us dey sick so.
11 Enemies don rape awa wifes for Jerusalem and dem don disgrace awa yong girls for Judah town.
12 Dem hang and kill di kings family kon trit awa eldas anyhow.
13 Dem karry awa yong men go do strong work and awa boys dey stagga, bikos of di heavy wood wey dem dey karry.
14 Awa eldas nor fit sidan for di town gate again and di yong men nor dey dance and sing again.
15 Joy nor dey awa heart again bikos wi wey bin sabi dance, don turn who dey mourn naw.
16 Awa crown don fall komot from awa head, bikos wi don sin and naw, wi dey sofa.
17 Bikos of dis, wi dey feel pain and wi nor dey si well again; awa eyes don dey weak, bikos wi don kry taya.
18 Mount Zion don empty and nobody dey der again, so naw, na wild animals dey stay der.
19 So Yu my Oga God, go rule forever and ever! Yor throne go dey from one generashon go rish anoda one.
20 But why Yu forget us like dis and wetin make Yu leave us since?
21 My Oga God, make Yu save and take us back as yor own! Make Yu give us di happiness wey wi get before.
22 Abi Yu don rijet us forever? Yu go kontinue to dey vex for us?