Joel 1pcm

1Dis na di message wey God give Joel wey bi Petuel pikin.

2Una wey bi leaders, make una listin! Evribody wey dey stay dis land, make una listin well-well. Anytin like dis don ever happen for una time or for una grand-grand papa dem time?

3Make una tell una shidren about am and make dem tell dia own shidren and dia shidren go tell dia shidren-shidren too.

4Ants don chop all wetin wi plant and as one set dey go, anoda set dey kom, until dem go chop and distroy evritin wey remain.

5Una wey dey drink anyhow, make una wake-up bigin kry. Una wey dey drink wine, make una kry; bikos dem don distroy di grape and all una sweet wine don finish.

6Many sojas from one strong kountry don kom attack awa land. Nobody fit kount dem and dia tit strong and sharp like lion own.

7Dem don distroy awa grapevines and skata awa fig trees. Dem tear di trees open, until di white part for di wood kon dey show.

8Make una kry like virgin wey dey mourn for di man wey e suppose marry.

9Di priest dem dey mourn, bikos wine and korn ofrin nor dey to offa for di temple again.

10Di farm don empty; di groun dey mourn, bikos dem don distroy all di korn. All di grapes and di olive trees don dry.

11Una wey bi farmer and doz wey dey kare for di vineyards, make una kry, bikos of una rice and sweet korn. Yes! All wetin wi plant don skata.

12Di grape vine and fig trees don dry and all di oda trees don die too. True-true, di pipol nor get joy again.

13Una wey bi priests wey dey serve for di altar, make una wear sak klot kon kry! Make una go mourn for di temple till day break, bikos korn and wine nor dey wey una go offa give una God!

14Koll and tell evribody sey make dem fast! Gada di leaders and all Judah pipol go meet and kry give God for en temple!

15God day don near, di day wen di Almighty go distroy evriwhere. Dat day go bad well-well!

16Wi just dey look as dem dey distroy awa food and wi nor fit do anytin. Nobody dey happy for God temple again.

17Di seed dem die for dry groun. No korn to keep, so awa store don empty and skata.

18All di melu dey kry bikos dem dey hongry and grass nor dey for dem to chop. Even di sheep demsef dey sofa.

19Oga God, na Yu I dey kry to, so make Yu kom help us! Di grass and trees don dry rish groun, bikos fire don burn dem.

20Even wild animals dey kry, bikos no wota to drink for anywhere and fire don burn all di grass finish.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Joel 1.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.