Joel 1
1 Dis na di message wey God give Joel wey bi Petuel pikin.
2 Una wey bi leaders, make una listin! Evribody wey dey stay dis land, make una listin well-well. Anytin like dis don ever happen for una time or for una grand-grand papa dem time?
3 Make una tell una shidren about am and make dem tell dia own shidren and dia shidren go tell dia shidren-shidren too.
4 Ants don chop all wetin wi plant and as one set dey go, anoda set dey kom, until dem go chop and distroy evritin wey remain.
5 Una wey dey drink anyhow, make una wake-up bigin kry. Una wey dey drink wine, make una kry; bikos dem don distroy di grape and all una sweet wine don finish.
6 Many sojas from one strong kountry don kom attack awa land. Nobody fit kount dem and dia tit strong and sharp like lion own.
7 Dem don distroy awa grapevines and skata awa fig trees. Dem tear di trees open, until di white part for di wood kon dey show.
8 Make una kry like virgin wey dey mourn for di man wey e suppose marry.
9 Di priest dem dey mourn, bikos wine and korn ofrin nor dey to offa for di temple again.
10 Di farm don empty; di groun dey mourn, bikos dem don distroy all di korn. All di grapes and di olive trees don dry.
11 Una wey bi farmer and doz wey dey kare for di vineyards, make una kry, bikos of una rice and sweet korn. Yes! All wetin wi plant don skata.
12 Di grape vine and fig trees don dry and all di oda trees don die too. True-true, di pipol nor get joy again.
13 Una wey bi priests wey dey serve for di altar, make una wear sak klot kon kry! Make una go mourn for di temple till day break, bikos korn and wine nor dey wey una go offa give una God!
14 Koll and tell evribody sey make dem fast! Gada di leaders and all Judah pipol go meet and kry give God for en temple!
15 God day don near, di day wen di Almighty go distroy evriwhere. Dat day go bad well-well!
16 Wi just dey look as dem dey distroy awa food and wi nor fit do anytin. Nobody dey happy for God temple again.
17 Di seed dem die for dry groun. No korn to keep, so awa store don empty and skata.
18 All di melu dey kry bikos dem dey hongry and grass nor dey for dem to chop. Even di sheep demsef dey sofa.
19 Oga God, na Yu I dey kry to, so make Yu kom help us! Di grass and trees don dry rish groun, bikos fire don burn dem.
20 Even wild animals dey kry, bikos no wota to drink for anywhere and fire don burn all di grass finish.