Job 12pcm

1Den Job ansa:

2“True-true, una know pass evribody. So wen una die, wisdom go follow una die too.

3But I get sense as yu get too. E nor get how yu take betta pass mi, bikos evribody know evritin wey yu dey tok.

4Even my friends dey laf mi naw; dem dey laf, but I know sey I nor do any bad tin. I bilive sey God go ansa my prayers.

5Yu nor get trobol, but yu still dey laf mi; pesin wey won fall before, yu don kuku nak am make e for kwik-kwik fall.

6But tif and pipol wey nor dey fear God dey live for peace, even doh na God hand dem dey.

7“Even bird and animals get many tins wey dem go tish yu.

8Make yu ask di eart and sea make dem kom tish yu wisdom.

9All of dem know sey na God by ensef dey kause all dis wahala for mi,

10bikos na God hand dey hold di eart and evribody dey alive bikos of en pawa.

11But as yor tongue dey taste food, na so too yor ear dey hear word.

12Old pipol get wisdom? Abi long life nor dey bring undastandin?

13But God get wisdom and pawa. E know and undastand many tins.

14Wen God skata, who go fit build am again? And who go fit free pesin wey God put for prison?

15Evriwhere go dry if God sey make rain nor fall and river go only flow wen God gi-am wota.

16Na God get strent and wisdom; di pesin wey dey lie and di one wey dem dey lie give, all of dem dey God hand.

17E dey make leaders bihave like fools kon take wisdom from rulers hand.

18E dey remove kings from dia throne kon make dem prisonas.

19E dey honbol priests and ova-trow doz wey dey pawa.

20E take di wisdom wey old pipol get kon silent doz wey dey advise odas.

21E disgrace princess kon take pawa komot from rulers hand.

22E open all di sekret tins wey dem hide for darkness kon put lite for where deep pass.

23Na-im dey give nashons pawa kon still skata dem again.

24E make leaders bi like fools kon make dem waka lost for desert.

25Dem dey waka find road for darkness. E make dem stagga like man wey don drink well-well.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 12.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.