Jeremiah 44pcm

1God tell mi about Israel pipol wey dey stay for Migdol, Tahpanhes, Memfis and all di oda towns wey dey Egypt sout.

2Israel God wey dey mighty sey, “Yu yorsef don si di way I take distroy Jerusalem and all di oda towns wey dey Judah. Dia town still skata and dem nor get hope again,

3bikos dem sin kon make mi vex. Dem offa sakrifice kon dey serve oda gods wey dem or yu or dia grand-grand papa nor ever woship.

4I dey send my savants and di profets kom meet dem, so dat dem go stop all dis wiked tins wey I hate,

5but dem nor gri listin or hear mi. Dem still dey offa sakrifice give oda gods.

6Na dis make mi pour my fire and vexnashon for Judah towns and all di street for Jerusalem. As e bi naw, dia life don skata and pipol wey si dem, dey fear.

7“So, mi wey bi Israel God dey ask, ‘Wetin make una dey distroy unasef? Nobody among una wey kom here from Judah go survive: weda na man or woman, pikin or di shidren wey dem just born. Dem go distroy all of una finish.

8Why una dey woship juju and sakrifice give Egypt gods? Na bikos una dey stay der? Abi una nor know sey una dey make mi vex? Una dey distroy unasef and na dis make all di nashons for di eart dey trit una anyhow kon use una name as curse!

9Una don forget all di wiked tins wey una grand-grand papa, Judah kings, dia wife, una and una wife do for Judah town and Jerusalem strits?

10But till naw, una neva gri honbol unasef. Una neva honor mi or live una life as I kommand una and una grand-grand papa.

11“ ‘Bikos of dis, mi wey bi Israel God, go turn against una kon distroy Judah.

12Den, Judah pipol wey remain, wey don make up dia mind sey dem won go Egypt, I go make sure sey, dem distroy dem finish. Both big and small go die for Egypt; weda na for war or honga. Pipol go si dem dey fear and dem go trit dem anyhow kon use dia name as curse.

13I go ponish all di pipol wey dey Egypt, just as I take war, honga and diziz take ponish Jerusalem pipol.

14Judah pipol wey kom stay Egypt, nobody among dem go eskape or survive. Nobody among dem go-go back to Judah, wey dem like to go stay again. Nobody go-go back, escept some slave.’ ”

15Den all di men wey know sey dia wife dey offa sakrifice give oda gods and di wimen wey stand der with Israel pipol wey dey stay for Egypt sout, all of dem kon gada kom tell mi sey,

16“Wi nor go listin to wetin yu tell us sey na God tell yu.

17Instead, wi go do evritin wey won do. Wi go offa sakrifice give awa goddes wey bi Heaven Kween kon pour wine for am too, just as wi, awa grand-grand papa, awa king and leaders dey do for Judah towns and Jerusalem strits before. Dat time, wi get plenty food to chop; wi dey prosper and wi nor get wahala.

18But since wi stop to sakrifice and pour wine give Heaven Kween, wi nor get anytin again and war with honga don early kill awa pipol finish.”

19Di wimen still sey, “Before wi bake kake wey bi like Heaven Kween or offa sakrifice or gi-am wine, wi dey first tell awa husband and dem dey gri with evritin wey wi dey do.”

20Den I tell all di men and wimen wey ansa mi like dis sey,

21“Una tink sey God nor know sey una and una grand-grand papa with una kings, ofisas and all di pipol dey burn incense give juju for Judah town and all di street for Jerusalem?

22Bikos God nor fit bear all di yeye tins wey una dey do, na dis make am turn una land to where pipol dey curse. E don skata am and pipol nor dey stay der again.

23All dis tins happen to una, bikos una offa sakrifice give oda gods kon sin against God wen una nor gri obey wetin E kommand.”

24Den I tell all di pipol, especially di wimen, “Wetin Israel God wey dey mighty tok about Judah pipol wey dey Egypt?

25Una and una wifes don promise Heaven Kween sey una go offa sakrifice kon gi-am wine and una don do as una tok. No problem at-all! Make una keep una word kon do wetin una promise!

26But naw, make una listin to di promise wey mi, God make with my strong name and dis promise na for Israel pipol wey dey Egypt: ‘I nor go ever let una use my name take make promise again or sey, “I swear with God wey get pawa!”

27I go make sure sey, una nor prosper and dem go distroy una finish. Diziz and war go kill una, until nobody go remain again.

28But some of una go eskape from Egypt kon go back to Judah. Den, doz wey survive go know wish pesin word happen. Weda na my own or dia own.

29Mi wey bi God go show una sign sey I go ponish una for dis place and as I promise sey I go distroy dis place, na so e go bi.

30Just as I give Zedekaya for Judah to King Nebukadnezzar for Babilon, na so too I go give King Hofra for Egypt to en enemies.’ ”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 44.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.