Jeremiah 39pcm

1For di tent mont inside di ninet year wen Zedekaya bi king for Judah, King Nebukadnezzar for Babilon kom attack Jerusalem with en sojas.

2Babilon sojas break enter Jerusalem for di ninet day for di fourt mont wen Zedekaya don dey rule for eleven years.

3Wen dem attack Jerusalem, Babilon sojas go pozishon demsef for di Middle Gate and Nergal-Sharezer wey kom from Samgar, Sarsechim and anoda Nergal-Sharezer wey bi senior ofisas dey among dem too.

4Wen King Zedekaya and all en sojas si wetin dey happen, dem kon try to run komot for di town for nite. Dem pass di gate wey join di two wall for back near di king gardin kon go Jordan River Valley.

5But Babilon sojas porshu dem kon katch Zedekaya near Jeriko. Den dem take am go meet King Nebukadnezzar for Riblah town wey dey Hamat land and na for der Nebukadnezzar for judge am.

6Dem force Zedekaya make e dey look as dem dey kill all en shidren and en ofisas for Riblah.

7Afta dat one, dem blind Zedekaya eye kon tie am with shain, den dem karry am go Babilon.

8By dat time, Babilon sojas don burn di royal palis and all di house wey dey Jerusalem rish groun, den dem kon skata di wall.

9Den Nebuzaradan, wey dey kommand di sojas kon karry di pipol wey remain for di town and di ones wey nor strong, go Babilon as prisonas.

10But e leave some poor pipol kon give dem vineyard and farm, so dat dem go dey work for der.

11But King Nebukadnezzar kommand Nebuzaradan wey bi di sojas oga sey make e go find Jeremaya kom.

12E tell am, “Make sure sey Jeremaya nor wound and yu go kare for am kon gi-am anytin wey e wont.”

13So Nebuzaradan, with some big ofisas wey bi Nebushazban, Nergal-Sharezer with all di oda Babilon king offisa

14kon bring mi kom di palis kourtyard. Dem sey make Gedalaya wey Shafan pikin Ahikam born, kare for mi and make sure sey I rish house well. So I kon stay my house for Judah with di pipol wey remain.

15Wen I still dey prison for di palis, God tell mi

16sey make I tell Ebed Melek wey kom from Ethiopia sey, “Israel God wey dey mighty sey, ‘Just as I promise, I go distroy dis town and nor-tin go remain.’ And yu go si am wen e dey happen.

17But mi, wey bi God go protet yu from di pipol wey yu dey fear.

18I go save yu and dem nor go kill yu. Yu go eskape with yor life, bikos yu trust mi. Mi, wey bi God, don tok.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 39.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.