Jeremiah 30pcm

1Na Israel God wey dey mighty

2tell mi sey: “Make yu rite evritin wey I tell yu put for one book,

3bikos time dey kom wen I go bring my pipol, Israel and Judah kom back to di land wey I give dia grand-grand papa and e go bi dia own again. Mi, wey bi God, don tok.”

4God tell Israel and Judah pipol:

5“I dey hear as una dey kry, bikos of una fear and di wahala wey una dey face.

6Naw, make una tink am well! Man fit get belle kon born pikin? So wetin make una men dey put dia hand for belle like sey dem bi woman wey won born? Wetin make evribody dey fear?

7Di day wen una go face sirious wahala dey kom and dem nor go fit kompare am with any oda day. Even doh di wahala go too mush for my pipol, dem go survive am.”

8God sey: “Wen dat day go kom, I go remove di load wey dey dia neck kon break di shain and dem nor go bi slave to strenjas again.

9Dem go serve mi wey bi di Oga dia God and na one of David shidren-shidren, go bi dia king.

10My pipol, make una nor fear; make Israel pipol nor fear at-all. I go save una from di far land where una dey as prisonas. Una go kom back to una house kon stay for peace and nobody go make una fear again.

11I go save and dey with una. I go distroy all di nashons where I skata una go, but I nor go distroy una finish. I go ponish una, but I go do am small-small. Yes! I nor go let una go without ponishment. Mi, wey bi God, don tok.”

12God tell en pipol, “Dem nor go fit cure una wound and una sore go dey forever.

13Nobody go kare for una or cure una sore; una nor get hope at-all.

14Doz wey love una, don forget una; dem nor kare about una again, bikos I don attack una like una enemy. Una ponishment go sirious well-well, bikos una wiked and don sin well-well.

15Make una nor komplain about una sore again, bikos e nor get cure. I dey ponish una like dis, bikos una wikedness and sin, too mush.

16But naw, doz wey distroy una, dem go distroy dem too and dem go karry all una enemies go Babilon as prisonas. Dem go opress doz wey dey opress una and doz wey tif from una, dem go tif from dem too.

17And even doh una enemies sey, ‘Zion nor mean anytin and nobody kare about am,’ I go make una well again kon heal una wound. Mi, wey bi God, don tok.”

18God sey, “I go bring my pipol kom back to dia land kon sorry for dem. Dem go build Jerusalem again and di king palis go dey as e bi before.

19Di pipol wey dey stay der go sing, praiz and dem go shaut for joy. My blessing go make dem many well-well and e go bring honor for dem.

20Dia shidren-shidren go bi as dem bi before and dem go always dey my present, den I go ponish di pipol wey bin dey opress dem.

21Dia leaders go kom from dia own nashon and dia prince go bi dia own pipol. E go kom meet mi wen I invite am, bikos nobody go fit kom wen dem nor invite am.

22Dem go bi my pipol and I go bi dia God. Mi, wey bi God, don tok.”

23God vexnashon go kom like heavy breeze! Like strong breeze wey go blow wiked pipol head komot.

24En vexnashon nor go stop until E don do evritin wey E plan to do. Afta sometaim, en pipol go undastand all dis tins. One day, una go undastand wetin I mean.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 30.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.