Jeremiah 27pcm

1Wen Josaya pikin Zedekaya just bi king for Judah, God tell mi

2“Make yu tie leda rope for wood kon put am for yor neck,

3den use am take send message go give Edom, Moab, Ammon, Tyre and Sidon kings thru di pesin wey dey ripresent dem wey dem send kom si King Zedekaya, for Judah.

4Tell dem make dem tell dia kings sey: ‘Israel God wey dey rule ova evritin sey:

5“Na with my mighty pawa and great strent I take kreate di eart, di pipol and di animals wey dey inside and I don give dis pawa to pipol wey I like gi-am to.

6Na mi put di nashons under my savant pawa, King Nebukadnezzar for Babilon and I kon make wild animals dey serve am.

7All di nashons go serve en and en shidren-shidren, until wen en own nashon go fall. Den Babilon go bi savant to nashons wey get pawa and great kings.

8But if oda nashon or kingdom nor gri serve or respet King Nebukadnezzar for Babilon, I go ponish dat nashon with war, honga, diziz and I go distroy am.

9Nor listin to anybody or profet wey sey e know wetin go happen tumoro; doz wey dey undastand dream; doz wey dey koll dead body or doz wey dey do majik; wey sey make una nor respet Babilon king.

10Make una nor listin to doz wey dey deceive una, bikos dis tin fit make dem karry una far; go where una nor know. I go drive una komot from una land and una go die for der.

11But if any nashon gri kon serve Babilon king, I go make dat nashon stay and chop from en own land. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”

12I tell King Zedekaya for Judah di same tin sey, “Make yu honbol yorsef kon respet Babilon king; serve en and en pipol and yu go dey save.

13Why yu wont make honga, war and diziz kill yu and yor pipol? Dat na wetin God don sey go happen to any nashon wey nor gri obey Babilon king.

14Nor listin to di profets wey sey make yu nor surenda to am; dem just dey deceive yu.

15God don sey, ‘I nor send dem and dem dey lie give yu with my name.’ So E go drive yu komot and dem go kill both yu and di profets wey dey lie give yu.”

16Den I tell di priest and di pipol: “God sey: ‘Nor listin to di profets wey sey dem go soon bring all di betta-betta tins for di temple kom back from Babilon. Dem just dey lie give yu.

17Nor listin to dem! Obey Babilon king and yu go dey save! Why yu wont make dis town turn to where dem go dey trowey dirty put?

18If dem really bi profet or get my message, make dem pray give mi, di God wey dey mighty sey, “Make Yu nor allow dem karry all di betta-betta tins wey remain for di temple and palis, go Babilon.

19Di God wey dey mighty don already tok about di two pila wey dem make with bronze; di sea, di stands and di tins wey remain for di town

20wen Nebukadnezzar, Babilon king kon karry Judah King, Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and en ofisas for Judah and Jerusalem, go Babilon as slave.

21So, make una listin to wetin mi wey bi Israel God wey get pawa dey tok about di betta-betta tins wey remain for Jerusalem temple and palis:

22Dem go karry dem go Babilon until di day wey I go remember dem. Den, I go bring una kom back kon give una evritin wey una don lost for dis place. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 27.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.