Jeremiah 24pcm

1Afta King Nebukadnezzar for Babilon don karry Jehoiakim pikin Jekonaya, wey bi King for Judah, en ofisas and all di pipol wey get handwork go Babilon, God kon show mi two basket wey fig fruit full for di temple front.

2Na good fig full di first basket; figs wey kwik ripe; but na bad fig wey dem nor go fit chop dey di sekond one.

3Den God tell mi, “Jeremaya, wetin yu dey si?” I ansa, “Na fig! Di good ones don ripe, while di bad ones don spoil.”

4So God tell mi,

5“Mi, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Di pipol wey dem karry go Babilon bi like dis good fig and I go trit dem well with kindness.

6I go kare for dem kon bring dem kom back to dis land. I go karry dem up and nor-tin go fit bring dem down. I go plant dem and nor-tin go fit rut dem.

7I go let dem know sey na mi bi God. Den, dem go bi my pipol and I go bi dia God, bikos dem go kom back kon serve mi with all dia heart.

8“ ‘But King Zedekaya for Judah, en ofisas and di pipol wey remain for dis land and doz wey go Egypt, mi wey bi God, go trit dem like dis bad fig wey don spoil.

9I go give dem wahala sotey all di nashons for di world go fear. Pipol go laf dem well-well; use dem dey make yeye kon dey curse dem for anywhere wey I skata dem go.

10I go bring war, honga and diziz kom meet dem, until nobody among dem go remain for di land wey I give dem and dia grand-grand papa.’ ”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 24.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.