Bible

Simplify

Your Church Tech & Streamline Your Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Jeremiah 22

:
Nigerian - pcm
1 God tell mi, “Make yu go Judah king palis kon tell am dis message:
2 ‘Judah king wey sidan for David throne, en ofisas and all en pipol wey dey pass dis gate, make una listin.
3 Dis na wetin God tok: “Make una do wetin dey good and korrect. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am. Make una nor trit or opress strenjas; doz wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die and make una nor kill innocent pipol for dis land.
4 If una really do wetin I kommand, den David shidren-shidren go kontinue to bi king. Both dem, dia ofisas and dia pipol go kontinue to ride horse pass dis palis gate.
5 But I swear sey, if una nor obey my kommand, dem go distroy dis palis rish groun. Mi, wey bi God, don tok.”
6 “Even doh Judah royal palis fine like Gilead land and Mount Lebanon, I go turn am to desert and pipol nor go stay der again.
7 I go send men kon distroy am. Dem go use dia axe take kut en fine cedar pilas kon trow dem for fire.
8 Wen pipol from oda nashons dey pass, dem go dey ask each oda, ‘Wetin make God do dis kind tin to dis great town.’
9 Den, some go ansa, ‘Na bikos dem forget dia kovenant wey dem make with dia God kon go serve and woship oda gods.’
10 “Judah pipol, make una nor kry and mourn for di king wey dem kill. But make una kry well-well for di one wey dem go karry go Babilon, bikos e nor go kom back to di land where dem for born am again.”
11 Dis na wetin God tok about Josaya wey bi Shallum pikin, wey take-ova from en papa as king, before dem karry am go Babilon. God sey, “E nor go ever kom back to dis land again.
12 E go die as slave for di kountry where dem dey karry am go and e nor go si dis land again.”
13 “E go bad for di king wey build big house with lie-lie and wayo. Di king wey make di men dey work for nor-tin and nor gri pay dem dia salari.
14 E go bad for di king wey sey, ‘I go build big house for mysef; di room for up go get betta space.’ So e put windows for di house, use cedar wood take dekorate am kon paint am with red kolour.
15 If yu take cedar wood build house and e fine pass oda pipol own, na dat one make yu bi betta king? Yor papa enjoy life well-well, bikos e always dey good and kind, so e prosper for evritin wey e do.
16 E judge poor pipol well and evritin go well with am, den God kon sey, ‘Dat na betta ezample to show sey yu know mi.’
17 But yu dey always tink and look for ways to use wayo take make plenty money. Na to kill innocent pipol and opress yor own pipol, yu dey always tink.
18 So, dis na wetin God tok about Josaya pikin, King Jehoiakim for Judah: ‘Nobody go mourn wen e die or tell en neighbour, “My friend, di king deat dey vex and pain mi!” Nobody go kry for am sey, “My oga and my king don die!”
19 Just as dem nor dey beri donkey wey die, na so too dem nor go beri am. Dem go drag en body komot from di town kon trow am outside Jerusalem.”
20 Jerusalem pipol, make una shaut and mourn as una dey go Lebanon. Make una kry go Bashan land; make una shaut well-well for Moab mountins, bikos dem don distroy una propaty.
21 Wen una dey prosper and enjoy, God tok to una, but una nor gri listin. Na so una dey bihave since and una nor gri obey God.
22 So breeze go blow una leaders trowey; dem go karry all una tins go. Den, dem go disgrace and make una shame, bikos of all di wiked tins wey una do.
23 Una fit tink sey una dey save like bird wey dey rest for Lebanon cedar. But wen di wahala kom, una go kry with pain like woman wey won born.
24 God sey, “As far as I bi di God wey dey alive, Jehoiakim pikin, Jekonaya wey bi king for Judah, yu nor go fit bi king for dis eart. I go take dat pawa komot from yor hand.
25 I go give yu to doz wey yu dey fear and wey won kill yu. I go give yu to King Nebukadnezzar for Babilon and en sojas.
26 I go force yu and yor mama wey born yu, go anoda kountry. Una go-go kountry where dem nor for born una and una go die for der.
27 Yu go like to kom back to dis kountry, but yu nor go ever kom back again.”
28 I sey, “King Jekonaya go bi like pot wey break wey dem trowey. E go bi like klay pot wey pipol nor won use at-all. Why dem go force en and en shidren go anoda kountry? Wetin make dem won take dem go kountry wey dem nor know anytin about?”
29 Judah land, Judah land, Judah land! Make una listin to wetin God won tok:
30 God sey, “Make yu rite dis man name as pesin wey nor get pikin and wey nor go ever susid for life. En shidren nor go ever rule for David throne for Judah again.”