Jeremiah 13pcm

1God tell mi, “Go buy and wear one short nika wey dem make with linen and make yu nor wosh am.”

2So, I kon go buy and wear am just as Oga God tok.

3Den God tell mi again sey,

4“Di short nika wey yu buy and wear so, pul and take am go Perat. Dig and hide am for one hole wey dey di rock near Eufrates River.”

5So I kon go hide am for Perat just as Oga God tok.

6Afta, God kon sey, “Go back go kollect di short nika for where yu beri and hide am put.”

7So I go di place kon dig di nika kom out, but I notis sey di nika don skata and tear well-well.

8Den God tell mi,

9“Na so I go take distroy Judah and Jerusalem pipol pride.

10Dis wiked pipol nor gri obey mi. Dem dey follow dia sturbon and wiked heart kon dey woship and serve oda gods. So dem go bi like dis nika wey nor get value again.

11Just as nika fine and dey tight pesin for waist, na so I wont make Israel and Jerusalem pipol whole mi tight. So dat dem go bi my pipol wey go dey praiz and honor my name; but dem nor gri obey mi.”

12Di Oga wey bi Israel God kon tell mi, “Jeremaya, if yu tell Israel pipol make dem pour wine full dia wine pot, dem go ansa yu, ‘Yes! Wi know sey wine suppose full awa pot.’

13Den, yu go tell dem, ‘All di pipol wey dey dis land, God go give dem wine drink until di wine don katch dem: both di kings wey kom from David family, di priests, profets and all Jerusalem pipol.’

14E go skata dem like pot wey fall press each oda kon break. Na so too shidren go bi to dia papa and mama. I nor go pity or sorry for dem. I must distroy dem and nor-tin go fit stop mi.”

15Den I tell Israel pipol, “God don tok! So make una dey honbol and listin to am!

16Make una respet di Oga una God, before E go bring darkness wey go make una kick stone fall on-top mountins! Make una respet am, before E go turn una lite to darkness.

17But as una nor gri listin, I dey kry for sekret, bikos of una pride; I go kry well-well till I nor fit kry again, bikos dem don karry God pipol go as slave.”

18God tell mi, “Make yu go tell di king and en mama sey, make dem komot for di throne, bikos dia fine crown don fall komot for dia head.

19Enemies don surround Judah town wey dey sout and nobody go fit enter or go outside. Dem go karry evribody for Judah go as slave.”

20Jerusalem pipol, make una si, una enemies dey pass nort dey kom! Where di pipol wey dey kare for una, di pipol wey make una dey proud?

21Wetin una go tok wen di pipol wey una bin tink sey bi una friends katch, distroy and kon dey rule una? E go pain una like woman wey won born?

22And wen una ask, “Wetin make all dis tins dey happen to us? Why dem tear awa klot komot from awa body kon trit us like ashawo? Na bikos of sin?” Yes! Na bikos una don sin.

23Black man fit shange en skin kolour, abi leopard fit komot di mark wey dey en body? If dem nor fit, den e go hard for wiked pesin to do good, bikos na only to do bad tins, e sabi.

24So dat na why God go skata una like dirty wey strong breeze blow trowey.

25E sey dis na wetin go happen to una, bikos una forget am kon trust lie-lie gods.

26Na only God go tear una klot komot for una body kon disgrace una.

27Jerusalem pipol! I don si as una dey do ashawo waka and as una dey run follow difren juju for fields and for evry hill. Naw, make una si di wahala wey dey wait una. So, una go ever dey klean to woship mi again?

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 13.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.