1Yu wey get money, make yu listin! Cry make dem hear yor vois, bikos of di bad tins wey go happen to yu.
2Yor money don rotin and ants don chop yor klot.
3Yor gold and silva don rust, dia ashes go tok against yu and chop yor flesh like fire. For di last days, yu don gada money and fine tins for yorsef!
4Si, di money wey yu nor gri pay di workers wey dey work for yor farm, dey kry against yu and di pipol wey dey gada wetin yu plant, dia kry don rish God ear.
5Yu dey live life wey yu dey enjoy and yu dey enjoy for dis eart. Yu don make yorsef fat, dey wait for di day wey dem go kill yu.
6Yu don kondemn and kill pipol wey nor do bad, bikos dem nor fit stop yu.
7My brodas and sistas, make una get patient till Christ go kom back. Tink how farmer dey wait for wetin e plant until e grow kon bring food wey dear and e dey wait with patient for am, until di first and di last rain go fall put.
8So, make una get patient too and make una heart strong, bikos di time wen Christ go kom back, don near.
9My brodas and sistas, make una nor dey komplain about each oda, so dat dem nor go judge una, bikos God wey bi di judge, stand near di gate.
10Di profets wey God send kom tok to una, make una use dem as ezample to bear sofa and get patient.
11Make una tink of how wi dey look pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una hear how Job get patient and how God bless am leta. God get mesi and E dey sorry for pesin well-well.
12My brodas and sistas, make una remember dis kommand pass oda ones; make una nor swear, weda with heaven or eart or any oda tin. But make una let una “Yes” bi yes, and una “No” bi know, so dat una nor go fall enter God judgement.
13If anybody dey sofa among una, make e pray. If anybody dey happy among una, make e sing dey praiz God.
14If anybody among una nor well, make e koll di eldas for di church, make dem pray and use oil anoint am for Jesus name.
15Di prayer wey dem take faith pray go save di pesin wey nor well and God go make am well. And if e kommit any sin, God go forgi-am.
16So make una konfess una sin to each oda. Make una pray for each oda, so dat God go heal una. Di prayer wey pesin wey good for God eye take all en mind pray, dey work well-well.
17Elijah na human being like us and e pray with all en mind make rain nor fall. True-true, for three and half years, rain nor fall for dat place.
18Den e pray again and di sky kon bring rain and evritin wey dem plant, kon grow.
19My brodas and sistas, if anybody among una waka komot from di trut and pesin bring am kom back,
20make yu know sey, di pesin wey bring yu wey bi sina kom back from di bad way, don save yor soul from deat and e don make Christ forgive yu all yor sins.