Isaiah 62
1 I nor go rest bikos of Zion and bikos of Jerusalem I nor go kwayet until en raitiousness go shine kom out like morning lite and en salvashon like tosh wey dey shine well-well.
2 Jerusalem pipol! Nashons go si una viktory! Dia kings go si una glory. Dem go koll una with di new name wey God ensef give una.
3 For God hand, una go bi like crown wey get glory! Yes, una go bi like royal crown for God hand.
4 Dem nor go koll una “Pipol wey dem rijet again” or koll una land, “Di wife wey en husband drive komot house.” But dis na di new name wey dem go koll una, “God dey happy with una.” Dem go tell una land sey: “Yu marry well.” Dis na bikos God dey happy with una and E go bi like husband to una.
5 Like yong man wey marry virgin, na so too en wey form una, go marry una. As husband dey happy with en wife, na so una God go dey happy with una too.
6 Jerusalem pipol, I go put pipol wey go dey guide una walls and dem nor go kwayet both for day and nite. But una wey dey pray give God, make una nor stop at-all.
7 Make una nor let am rest till E build Jerusalem again kon turn am to town wey di whole world go dey praiz.
8 God don make betta promise and E go make am happen with en pawa den E go sey: “Enemies nor go chop una korn again and strenjas nor go drink una wine again.
9 But una wey plant and harvest di korn, go chop di bread kon praiz God. Una wey gada di grapes, go drink di wine for my temple yard.”
10 Jerusalem pipol, make una go outside di town go build road for una pipol wey dey kom back! Make una do betta road kon remove all di stones for der! Make una put one sign, so dat all di nashons go know
11 sey, God dey announce give di whole world naw sey: “Make una tell Jerusalem pipol sey God dey kom save dem and E dey kom with doz wey E don already save.”
12 Dem go koll una, “God holy pipol; di ones wey God save.” Dem go koll Jerusalem, “Di town wey God love and where E go stay forever.”