1“Bel and Nebo town don fall. Dem pak dia juju on-top donkey and naw, di juju too heavy for di donkey to karry.
2Di juju wey stand before don fall; dem nor fit save diasef and dem don karry di juju dem go as slave!
3So Jakob shidren-shidren, make una listin; una wey remain for Israel, pipol wey I dey kare for, since dem born una.
4Even wen una don old kon get white hair, I go still dey kare for una. Na mi kreate una, so I go support, help and save una.”
5God sey, “Na who una fit take kompare mi? Make una tell mi, abi e get anybody wey fit bi like mi?
6Pipol dey pour gold from dia bag kon measure dia silva. Dem go hire pesin wey go use di gold make juju for dem and den, kon woship am.
7Dem go karry am for dia shoulder dey waka kon go put am for where e go dey. E nor go fit komot for where dem put am. Even wen pesin pray to am, e nor go fit ansa or save di pesin from wahala.
8Una wey dey tok against God, make una remember and tink of all wetin God don do.
9Make una remember wetin happen before-before! Na mi bi God and e nor get any oda god. Yes! Na mi bi God and nobody bi like mi.
10I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.
11I koll one eagle kom from east; from one far land, di one wey dey kom do wetin I plan. Just as I tok, na so e go bi and wetin I plan, must happen.
12So, una wey sturbon and nor dey do di rite tin, make una listin to mi.
13I dey kom judge and diliver my pipol. E nor go tey again and di time to save dem don near. I go save Jerusalem kon honor Israel pipol.”