Bible

Elevate

Your Sunday Morning Worship Service

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Isaiah 42

:
Nigerian - pcm
1 God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.
2 E nor go shaut or make nois or dey tok waka for strits.
3 E nor go break di wood wey bend or lite lantan wey nor good. En good judgement go dey di whole world forever.
4 E nor go luz hope or start to fear. E go bring betta judgement kom evriwhere for di world and pipol for far-far land, dey wait make E kom tish dem.”
5 God wey kreate heaven kon stresh am out, wey make di eart and evribody wey dey inside, di Pesin wey give life to di pipol wey dey di eart and spirit to doz wey dey waka inside sey,
6 Na mi wey bi God choose yu to show as I good rish. I go hold yor hands kon guide yu and I go give yu to my pipol Israel, just to fulfil my kovenant. And yu go bi lite to guide oda nashons.
7 Yu go open blind pipol eyes, save doz wey dey darkness and free doz wey dey prison.
8 Na mi bi God and na my name bi dat; I nor go share my glory with anybody or let juju follow mi share my praiz.
9 “True-true, di tins wey I bin tok, don happen naw. So, I go tell una new tins naw, even before dem go start to happen.”
10 Make una sing new song to God! Make evribody for di world sing praiz God. Una wey dey drive on-top di sea and evry oda tins wey E kreate for inside, make una sing praiz am. All di far land and doz wey dey der, make una praiz am.
11 Make all di desert and en towns praiz God; Make Kedar pipol praiz am! Make doz wey dey stay for Sela town shaut dey happy on-top di mountins!
12 Make di pipol wey dey stay far, give God praiz and glory kon tok as E good rish!
13 God dey go fight war like strong soja; E dey ready to fight. E go shaut. Yes! E go shaut for war kon distroy and win en enemies.
14 God sey, “I kwayet since and I nor ansa my pipol, but di time to tok, don rish. Just as woman wey won born dey shaut, na so too I dey shaut naw.
15 I go distroy di hills and mountins kon make di grass and trees dry. I go turn di river to desert kon dry all di place wey wota from dey flow.
16 I go lead doz wey nor dey si, pass di road wey dem neva travel pass before. I go turn dia darkness to lite kon make rof road smooth for dem. Dis na wetin I promise and I go do dem; I nor go fail.
17 But for all of una wey trust juju, wey dey koll image una gods, dem go sofa and disgrace una.”
18 God sey, “Una wey nor dey hear word, make una listin! Una wey nor dey si, make una look well-well!
19 E get anybody wey blind pass my savant or deaf pass di messenja wey I send?
20 Israel pipol, una don si many tins, but wetin dem mean to una? Una get ear to take hear, but wetin una don really hear?”
21 God wont make dem know how E dey judge thru en raitiousness and how E dey show am.
22 But naw, dem don tif all en pipol tins; lock dem undagroun kon hide dem for prison. Dem tif from dem kon karry all dia tins komot and nobody dey to save dem.
23 Naw, who among una go gri listin to dis tin? From naw go, una go gri listin with kare?
24 Who sell Israel give di tif dem? Na God ensef wey wi sin against! Wi nor dey live awa life just as E wont or obey wetin E tish us.
25 So E make us si how E dey vex kon make us sofa di pains. En vexnashon dey burn like fire for evriwhere for Israel, but wi nor know wetin bin dey happen and wi nor still learn anytin from am.