Isaiah 4pcm

1For di last days, seven wimen go hold one man kon sey, “Wi go feed and buy klot for awasef, but make yu just let us koll yu awa husband, so dat pipol nor go laf us, bikos wi nor get husband.”

2For dat time, God go make evry plant and tree grow big and fine well-well again. All di pipol wey go survive for Israel, go like di tins wey di land go produce.

3Den doz wey God save wey go remain for Jerusalem, pipol go koll dem, “holy pipol.”

4God go use en pawa take judge and make di nashons holy. E go forgive Jerusalem pipol dia sins kon klean di land bikos of pipol wey dem kill for der.

5Den God go kover and guide Mount Zion with all di pipol wey gada der with kloud for day time and fire for nite. Yes! God glory go kover and protet di whole town.

6For day time, God glory go kover di town from strong heat kon protet am from heavy rain.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Isaiah 4.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.