Isaiah 17
1 Dis message na about Damaskus pipol, “Si, Damaskus town go disappear and e go turn where dem dey trow dirty put.
2 Dem go abandon Siria town forever and animals go dey go chop grass for der and nobody go ever drive dem.
3 Nobody or town go defend Israel land again and na oda pipol go rule Damaskus. Pipol wey go survive for Siria, dem go disgrace dem like Israel pipol. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”
4 God sey, “For dat time, Israel pipol pawa go finish and na sofa go bi dia own.
5 E go bi like wen pesin gada rice kon blow di kanda trowey. Just like wen pesin dey blow kanda komot from rice for Refah Valley.
6 Na only few pipol go survive for Israel and e go bi like olive tree wey dem plok all en fruit komot kon leave like two or three fruit for en branches. Mi, wey bi Israel God, don tok.”
7 Wen dat day rish, pipol go trust God wey kreate dem; dem go depend on Israel God wey bi di King of all kings.
8 Dem nor go put dia hope for di altar wey dem make with dia hand or trust Asherah juju or di incense altar wey dem still make with dia hand.
9 For dat time, dia strong town go skata and dem go run komot der like di town wey Hiv and Ammon pipol abandon bikos of Israel pipol.
10 Israel pipol don forget di God wey save and protet dem like big rock. And naw, dem plant betta flowers and vines kon dey woship dem.
11 True-true, di day una start to plant, una dey do evritin wey una fit do, so dat di plant go grow. Di morning wey una start to klean di land, una dey do evritin wey una fit do to make di plant survive, but una nor go si anytin harvest and na only diziz and pain go follow una.
12 So all di strong nashons wey gada togeda nor betta pass pipol wey don die; dem just dey make nois like wave for sea.
13 Even doh dis pipol dey make nois like heavy wave for sea, wen God shaut for dem, dem go turn run go one far land and na breeze go karry dem like leaf for hill or like dirty wey strong breeze blow.
14 For evening, dem go dey fear kon vanish before day break. Dis na wetin go happen to pipol wey dey trobol and won tif from awa land.