Isaiah 17pcm

1Dis message na about Damaskus pipol, “Si, Damaskus town go disappear and e go turn where dem dey trow dirty put.

2Dem go abandon Siria town forever and animals go dey go chop grass for der and nobody go ever drive dem.

3Nobody or town go defend Israel land again and na oda pipol go rule Damaskus. Pipol wey go survive for Siria, dem go disgrace dem like Israel pipol. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”

4God sey, “For dat time, Israel pipol pawa go finish and na sofa go bi dia own.

5E go bi like wen pesin gada rice kon blow di kanda trowey. Just like wen pesin dey blow kanda komot from rice for Refah Valley.

6Na only few pipol go survive for Israel and e go bi like olive tree wey dem plok all en fruit komot kon leave like two or three fruit for en branches. Mi, wey bi Israel God, don tok.”

7Wen dat day rish, pipol go trust God wey kreate dem; dem go depend on Israel God wey bi di King of all kings.

8Dem nor go put dia hope for di altar wey dem make with dia hand or trust Asherah juju or di incense altar wey dem still make with dia hand.

9For dat time, dia strong town go skata and dem go run komot der like di town wey Hiv and Ammon pipol abandon bikos of Israel pipol.

10Israel pipol don forget di God wey save and protet dem like big rock. And naw, dem plant betta flowers and vines kon dey woship dem.

11True-true, di day una start to plant, una dey do evritin wey una fit do, so dat di plant go grow. Di morning wey una start to klean di land, una dey do evritin wey una fit do to make di plant survive, but una nor go si anytin harvest and na only diziz and pain go follow una.

12So all di strong nashons wey gada togeda nor betta pass pipol wey don die; dem just dey make nois like wave for sea.

13Even doh dis pipol dey make nois like heavy wave for sea, wen God shaut for dem, dem go turn run go one far land and na breeze go karry dem like leaf for hill or like dirty wey strong breeze blow.

14For evening, dem go dey fear kon vanish before day break. Dis na wetin go happen to pipol wey dey trobol and won tif from awa land.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Isaiah 17.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.