Bible

Designed

For Churches, Made for Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Isaiah 14

:
Nigerian - pcm
1 Oga God go pity en pipol, Israel. E go choose dem as en own kon let dem stay di land again and strenjas go kon stay der with dem.
2 Oda pipol go help Israel pipol kom back to dia land. Israel pipol go kom back to di land wey God give dem and pipol go serve dem. Den Israel pipol go opress doz wey bin katch dem kon rule di pipol wey bin sofa dem.
3 Wen God don free Israel pipol from dia pain, sofa and di hard work wey dem force dem to do,
4 dem go laf Babilon king kon sey, “Make una si as evritin take end for di king wey dey opress pipol! E nor go ever fit opress anybody again!
5 God don break wiked pipol pawa and di hand wey dem take dey rule.
6 Dem vex skata and kill pipol for oda kountries and dem nor dey taya. Dem vex rule oda kountries as dem like kon dey opress di pipol and e nor taya dem.
7 But naw, di whole eart dey rest; get peace and evribody dey sing with happiness.
8 Cypress trees and cedars for Lebanon dey happy bikos di king don fall, so nobody go kut dem trowey again.
9 Pipol wey don die, dey happy to welkom Babilon king. Pipol wey dey strong well-well wen dem dey life, dia ghost dey wait am and all di former kings ghost raiz from dia throne dey wait am too.
10 All of dem dey sey, ‘Naw, yu don dey weak like us! Yu don bi like us!
11 Before-before, dem dey play music with harp to give yu respet, but naw, yu dey with dead pipol. Yu liedan for worm bed kon use di worms take do kover klot.’
12 Babilon king, yu wey bi di morning star wey dey shine; make yu si as yu fall from heaven, just as devil fall! Before-before, yu katch many pipol, but naw, dem don trow yu for groun.
13 Yu bin tell yorsef sey, “I go klimb go heaven go put my throne on-top di highest stars. I go sidan and rule like king for di highest mountin.
14 I go klimb go di place wey high pass for di kloud. I go bi like di Most High God!”
15 But God don bring yu down to di place wey deep pass and na der dead body dey stay.
16 Dead body dem go look yu kon ask demsef, “Nor bi dis man bin dey shake di eart kon make kingdoms dey fear?
17 Nor bi dis man distroy towns kon turn di world to desert? Yes! Na di man nor gri free en prisonas make dem go dia house!”
18 And all di kings for di world liedan for dia grave,
19 but yu nor get grave, just like bullet wey dem shot trowey. Yor dead body just dey groun with oda pipol wey dem kill with swod; with pipol wey dem won go trow dia dead body for pit.
20 Dem nor go beri yu like oda kings, bikos yu distroy yor own land kon kill yor pipol. Nobody from yor wiked family go survive.
21 Make dem bigin kill di king sons, bikos of dia grand-grand papa sin. No one among dem go rule for dis world or build towns again.
22 God wey get pawa sey, “I go attack and skata Babilon. I nor go leave anytin or pesin for der; nobody go survive at-all and pipol nor go remember am again. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.
23 I go turn Babilon to where birds and wild animals dey stay and wota wey nor dey go front or back, go full di land. I go swip am trowey, just as pesin dey use broom take swip dirty trowey.”
24 God wey dey lead heaven sojas swear sey, “Make una know sey na as I plan am, na so e go bi and as I tok am, na so e go happen too.
25 I go distroy Assyria pipol for my land. I go skata dem put under my hill. I go free my pipol and remove di load wey Assyria pipol put for dia shoulder.
26 Dis na wetin I plan for di whole eart; my hand dey ready to ponish di nashons.”
27 True-true, God wey dey lead heaven sojas get plan and who go fit stop wetin E won do? En hand dey ready to ponish anybody. So who go fit stop am?
28 Na for di year wey King Ahaz die, God take send dis message:
29 Filistia pipol, di kane wey dem take flog una don break, but make dat one nor make una dey happy. If one snake die, di one wey bad pass go take-ova, bikos na dragon go fly kom out from di snake egg.
30 Na God dey guide and save poor pipol. But E go make honga kill Filistia pipol finish.
31 Filistia towns! Make una shaut and kry for help. Make una fear, bikos betta smoke dey kom meet una from nort and dem bi strong sojas wey nor dey fear.
32 How una go take ansa di messenjas wey dey kom meet una from Filistia land? True-true, God don make Zion great and en pipol wey dey sofa, go dey save for der.