Hosea 12pcm

1Na breeze Efraim pipol dey chop. Dem dey porshu breeze from morning go rish nite. Dem dey gada lie and wahala kon enter agriment with Assyria and dey do business with Egypt pipol.

2Naw, God get wetin E go tok against Judah pipol. E go ponish Jakob shidren bikos of di way dem dey bihave. E go pay dem back for wetin dem don do.

3Even for dia mama belle, Jakob struggol with en broda Esau and wen Jakob grow, e still struggol with God.

4E fight with God angel kon win. E beg di angel make e bless am. E meet God for Bethel and God kon tok with am for der.

5Oga God wey dey mighty; na God bi en name forever.

6So, make una turn kom meet una God. Make una show love; dey judge well and dey patient as una dey wait for God.

7But Israel pipol nor dey tok true; dem bi like Kanaan pipol wey dey shit and play dia customers wayo.

8Efraim pipol sey, “Wi get money well-well and nobody go fit akuse us sey wi use wayo take get awa money.”

9“But na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt; I go make una stay for tent again, just as e bi wen una dey do Shelta Feast.

10I send my profets kon warn una with many vishon and parabol.

11But Jabesh-Gilead pipol nor mean anytin bikos dem dey woship juju. And dem dey sakrifice animals for Gilgal; dia altars bi like stones wey dem gada togeda for field wey dem klear.

12Jakob run go Aram land. For der, e kare for sheep, to take pay for en wife.

13Na profet God take save Israel pipol from Egypt where dem bi slave and na profet e take guide dem.

14But Efraim pipol make God vex well-well; so E go ponish dem bikos of di innocent pipol wey dem kill kon pay dem back for dia sin.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Hosea 12.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.