Habakkuk 1pcm

1Dis na di message wey God give Profet Habakkuk:

2Oga God, e don tey wen I dey kry make Yu kom help mi, but Yu nor gri ansa! I kry sey, “Trobol dey evriwhere!” But Yu nor still gri kom save mi.

3Why Yu allow mi dey face dis kind trobol? Must I si all dis wahala wey dey happen to mi? Anywhere wey I look, na only wahala and distroshon I dey si. Na pipol wey love to kworel and fight, dey round mi.

4Bikos of dis, di law dey weak and yuzles and doz wey dey judge, nor dey judge well at-all. Wiked men dey opress good pipol; dem don turn betta judgement up-side-down.

5God ansa, “Make yu look di nashons well and wetin yu go si, go sopraiz yu! I go do sometin naw wey yu still dey alive and even wen pesin tell yu, yu nor go bilive.

6I won give Babilon pipol pawa; doz wiked pipol wey nor dey sorry for odas. Dem go mash round di world kon seize all di oda nashons.

7Pipol dey fear dem well-well and dem dey do wetin dem like.

8Dia horse fast pass leopard and e wiked pass wolf for desert. Dia men dey ride di horse kom; dem bi like eagle wey dey rush go kill en enemy.

9All of dem dey kom with wahala; dey rush dey kom like breeze for desert and dem go gada di pipol wey dem katch like sey dem dey gada san.

10Dem dey ponish kings and use dia leaders make yeye. Dem dey laf all dia strong-strong towns. Dem dey kover towns with san-san kon seize dem.

11Dem dey pass like breeze wey dey blow. But dem really dey guilty, bikos dem bilive sey, na dia pawa as dia god.”

12My Oga God, di Pesin wey dey holy, Yu wey dey since and go always dey. Oga God wey bi awa Rock, Yu nor dey plan to kill us finish, Yu only send Babilon pipol to kom korrect and ponish us bikos of awa sin.

13Yor eyes too dey holy to si bad tins and Yu nor dey like si pipol wey dey do wiked tins. So wetin make Yu dey sorry for dem? Wetin make Yu kwayet wen wiked pipol dey distroy pipol wey good pass dem?

14Yu dey trit pipol like fish for sea or like animal for wota wey nor get who dey kontrol dem.

15Babilon pipol dey hook and katch pipol like fish kon karry dem go for net as dem dey happy bikos of wetin dem katch.

16Dem even dey woship and offa sakrifice give dia net kon dey sey, “Na dis net bi di god wey make us get money well-well!”

17Yu go allow dem ponish pipol forever? Dem go dey distroy nashons forever?

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Habakkuk 1.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.