Genesis 5pcm

1Dis na di rekord of Adam family. Wen God kreate human being, E make dem just as E bi.

2Na both man and woman E kreate kon bless and koll dem, “Human being.”

3Wen Adam don old rish hundred and thirty years, e kon get one pikin wey bi like am and en name na Seth.

4Afta Adam born Seth, e still stay for anoda eight hundred years and for dis time, e still born many sons and dotas.

5Di total days wey Adam live, na nine hundred and thirty years and e kon die.

6Wen Seth don stay for one hundred and five years, e kon born Enosh.

7Seth dey for eight hundred and seven years again and e born some oda sons and dotas.

8Di total life wey Seth live na nine hundred and twelf years and e kon die.

9Wen Enosh don stay for ninty years, e kon born Kenan.

10Enosh stay for eight hundred and fifteen years afta e don born Kenan and e born oda shidren.

11Di total life wey Enosh live na nine hundred and five years, den e kon die.

12Wen Kenan don live for seventy years, e kon born Mahalalel.

13Kenan live for eight hundred and forty years afta e born Mahalalel and e born oda shidren.

14Di total life wey Kenan live na nine hundred and ten years and e kon die.

15Wen Mahalalel don live for sixty-five years, e kon born Jared.

16Mahalalel stay for anoda eight hundred and thirty years afta e born Jared and e born oda shidren.

17Di total life wey Mahalalel live na nine hundred and ninty-five years and e kon die.

18Wen Jared don live for one hundred and sixty-two years, e kon born Enoch.

19Jared live for anoda eight hundred years and e get oda sons and dotas.

20Di total life wey Jared live na nine hundred and sixty-two years and e kon die.

21Wen Enoch don live for sixty-five years, e kon born Metuselah.

22Afta e born Metuselah, Enoch do as God tell am for three hundred years and e get oda sons and dotas.

23Di total life wey Enoch live na three hundred and sixty-five years.

24Enoch waka with God, den e vanish, bikos God take am.

25Wen Metuselah don live for one hundred and eighty-seven years, e kon born Lamek.

26Metuselah live anoda 700 and eighty-two years afta e born Lamek, en brodas and sistas.

27Di total life wey Metuselah live na nine hundred and sixty-nine years, den e kon die.

28Wen Lamek don live for one hundred and eight two years, e kon born boy.

29E koll di boy Noah kon sey, “Dis one go give us rest from all di hard-hard work wey wi dey do from dis groun wey Oga God don curse.”

30Lamek live for five hundred and ninty five year afta e born Noah and e still get oda shidren.

31Di total life wey Lamek live na seven hundred and seventy-seven years and e kon die.

32Afta Noah don stay for five hundred years, e kon born Shem, Ham and Jafet.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Genesis 5.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.