1Na dis bi family wey Noah shidren: Shem, Ham and Jafet born, afta di flood happen.
2Jafet shidren na Gomer, Magog, Madai, Javan, Tubal, Meshak and Tiras.
3Gomer kon born Ashkenaz, Rifat and Togarmah.
4Javan shidren na Elisha, Tarshish (wey bi Spain naw), Kittim pipol dem (wey bi Cyprus naw) and Dodanim pipol (wey bi Rhodes naw.)
5Na dem bi di grand-grand papa to di pipol wey dey di land wey wota surround. Na dem bi Jaflet shidren-shidren.
6Ham shidren na Kush, Mizraim, Put and Kanaan.
7Kush shidren na Seba, Havilah, Sabtah, Rama and Sabteka. Rama shidren na Sheba and Dedan.
8Kush na Nimrod papa, dis Nimrod kom bi warrior for di eart.
9En na strong hunta for Oga God front. Dat na why dem dey sey, “Just like Nimrod wey bi strong hunta for God present.”
10For di first time, en kingdom na Babel wey bi Babilon, Erek, Akkad and Kalneh wey dey Shinar land.
11From dat land, e kon go Assyria where e for build Nineveh, Rehobot, Kalah
12and Resen where dey di centre for Nineveh and di great town wey bi Kalah.
13Mizraim (wey bi Egypt naw) shidren na Lud pipol (wey bi Lydia naw), Anam, Lehab, Naftuh,
14Patrus, Kasluh (na from dem Filistia pipol from kom) and Kaftor pipol.
15Kanaan shidren na Sidon wey bi en first pikin, Het,
16Jebus, Amor, Girgash,
17Hiv, Ark, Sin,
18Arvad, Zemar and Hamat pipol. Leta, Kanaan family kon skata
19and dia land kon wide from Sidon to Gerar go rish Gaza and from der to Sodom, Gomorrah, Admah and Zeboiim till e rish Lasha.
20Dis na Ham shidren akordin to dia family, dia language, lands and kountries.
21Dem still born some sons give Shem (wey bi Jafet senior broda) and na Shem bi papa to all Eber sons.
22Shem shidren na Elam, Asshur, Arfaxad, Lud and Mash.
23Aram shidren na Uz, Hul, Geta and Mash.
24Arfaxad na Shelah papa and Shelah na Eber papa.
25Eber get two sons: One name na Peleg, bikos na en time dem take divide di eart and en broda name na Joktan.
26Joktan shidren na Almodad, Shelef, Hazar-Mavet, Jerah,
27Hadoram, Uzal, Diklah,
28Obal, Abimael, Sheba,
29Ofir, Havilah and Jobab dem na Joktan sons.
30Where dem dey stay na from Mesha go rish Sefar for di hill for east.
31Dis na Shem sons akordin to dia family, language, lands and kountry.
32Dis na Noah family akordin to dia generashon, kountry and dia pipol kon full di eart afta di rain don fall finish.