Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Galatians 1

:
Nigerian - pcm
1 Na mi Paul, rite dis leta, (nor bi human being make mi apostle, but na Jesus Christ and God awa Papa wey raiz am from deat).
2 Mi and di brodas wey dey here, dey greet una wey dey Galatia.
3 Make God awa Papa and Oga God Jesus Christ grace and peace, dey with una.
4 Na Jesus die for awa sins, bikos na so God awa Papa wont am.
5 Make all glory bi en own forever and ever! Amen.
6 I sopraiz sey una kwik turn back from di Pesin wey koll una with en grace kon bigin follow oda tishing.
7 Nor bi sey anoda gospel really dey, but some pipol dey disturb una, bikos dem won shange wetin wi prish about Christ.
8 But if wi (or angels wey kom from heaven) tish una difren tins from di one wey wi prish give una before, make God distroy us with fire!
9 As I tok before, I dey repeat am again, if anybody dey tish difren tins from di ones wey wi prish give una before, make God trow dat pesin for hell!
10 Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again!
11 My brodas and sistas, I wont make una know sey di gospel wey I dey prish, nor bi human being give mi.
12 Bikos I nor get or learn am from anybody, but I get am thru di revelashon wey Christ give mi.
13 Una don hear about di kind life wey I dey live before as Jew pesin; how I trobol di church kon dey try to distroy am.
14 I grow among Jew pipol kon know di relijon pass many of my mates for my kountry and I know my grand-grand papa dem tradishons.
15 But God koll mi with en grace kon separate mi even before dem born mi.
16 E show mi en pikin, so dat I go fit prish about am give Gentile pipol. I nor go meet anybody make e advise mi
17 and I nor go Jerusalem go meet pipol wey bi apostle before mi, but I komot der go Arabia, den I kon go back to Damaskus.
18 Afta three years, I go visit Pita for Jerusalem, so dat e go tell mi wetin I go do and I stay with am for fifteen days.
19 But I nor go si any oda apostle apart from James, wey bi Jesus Christ broda.
20 God dey si wetin I dey rite, bikos evritin wey I dey rite to una so, na true!
21 Afta dis, I kon go Siria and Silisia aria.
22 But di pipol for di church wey dey Judea, nor know mi.
23 Dem only dey hear sey, “Di pesin wey dey trobol us before, don dey prish di message wey e bin dey try to distroy.”
24 So dem kon dey praiz God bikos of mi.