Ezekiel 7pcm

1God tell mi,

2“Man pikin, dis na wetin mi wey bi Oga God dey tell Israel pipol. Di end don rish for evriwhere for di land!

3Una end don kom. Una go feel my vexnashon, bikos I dey judge una akordin to wetin una do. I go pay una back for all di bad-bad tins wey una don do.

4I nor go leave or sorry for una. I go ponish una for di bad tins wey una do, so dat una go know sey na mi bi God.”

5Dis na wetin God wey get pawa tok: “Israel pipol, I go ponish una well-well.

6E don finish for una. Na una end bi dis. Una own don finish.

7Una wey dey di land, wahala dey kom meet una. Di time go soon rish wen una nor go dey do party for di juju house wey dey di mountin, but na so-so kry una go dey kry.

8E nor go tey before una go feel as my vexnashon strong rish. I go judge una akordin to wetin una do and I go pay una back for all di wiked tins wey una do.

9I nor go sorry for una or show una mesi. I go ponish una for di bad tins where una don do, den una go know sey na mi bi God and na mi dey ponish una.”

10Si! Di day for strong wahala dey kom. Trobol go take-ova evriwhere and pipol go dey karry body anyhow.

11Wahala don turn swod wey go ponish wiked pipol. Nor of dia tins go remain: dia money, propaty, happiness and glory, all of dem go vanish.

12Di time don rish! Di day don kom. Naw, doz wey dey buy nor dey happy and make doz wey dey sell, mourn, bikos God go ponish evribody.

13Doz wey dey sell nor go get dia money back wen dem still dey alive, bikos God vexnashon na for all of dem. All dis sinnas go die finish and nobody go remain.

14Even doh sey dem blow di trumpet and all di sojas for Israel dey ready, nor of dem go gri go fight, bikos I dey vex for all of dem.

15Pipol go dey fight each oda for street, but for house, na sickness and honga go dey der. Anybody wey dey outside di town go die for di fight and evribody wey dey house, na sickness and honga go kill dem.

16Some of dem go run go di mountin like doves wey run from valley. All of dem go kry, bikos of dia sins.

17Evribody hand go dey weak and dia legs go dey shake.

18Dem go wear sak as klot for body and dem go dey fall as dem dey waka. Dem go skrape dia head and na shame go follow dem.

19Dem go trowey dia gold and silva for di street like sey na dirty, bikos gold or silva nor go fit save dem wen God vexnashon go kom and dem nor go fit use am get wetin dem wont or chop am like food and na dis gold and silva make dem sin.

20Before-before, dem dey make yanga with dia fine-fine tins kon take di tins do juju. So na bikos of dis, God make dia money and propaty dey yuzles.

21God sey, “I go let strenjas tif am from dem and pipol wey nor dey obey di law, go take all dia gold kon spoil am.

22I nor go tok wen tif dey distroy and rob my temple.

23So make dem prepare to shain my pipol, bikos na dead body full di land and na wahala full di town.

24Di pipol wey bad pass, I go bring and let dem tif una house. Una men wey get pawa go run with fear wen I allow pipol kon skata where una for dey woship.

25Trobol dey kom. Una go look for peace, but una nor go si am.

26One diziz go follow anoda and na so-so bad-bad news una go dey hear. Una go beg di profets make dem tell una wetin dem si. Di priest nor go get anytin to tish di pipol and una eldas nor go fit give betta advise.

27Di king go kry well-well; di prince nor go get hope again and di pipol go dey shake, bikos dem dey fear. I go ponish una for evritin wey una do and just as una judge oda pipol, na so too I go judge una. Den una go know sey na mi bi God!”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Ezekiel 7.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.