Ezekiel 42pcm

1Den di man take mi go di kourtyard for outside and wi pass di building for di nort side for di temple wey nor far from di one wey dey di west side for di temple.

2Dis building long rish one hundred and seventy-five fit for di nort side and wide rish eighty seven and half fit.

3Opposite di space wey bi thirty-five fit wey dey for di kourt for inside and outside, dem build am as three story and dem face each oda.

4For di nort side, dis building passage wide pass seventeen and half fit.

5Naw, di room on-top di building small pass di ones wey dey middle and bottom, bikos e big pass di down and middle rooms,

6bikos dem build dem as three story and dia pilas nor tick like di kourt own; so di top own nor tosh groun like di down and middle floor.

7But for di outside wall for di building wey face di main door-mot, e long pass eighty seven fit.

8Di room for di outside kourt long rish eighty seven and half fit, while di ones wey face di temple, long rish one hundred and seventy-five fit.

9Under di rooms, for di east end for di building, na der di wall for start, e still get where dem dey pass enter di kourtyard for outside.

10For der, e get one room wey resemble di rooms for di sout-side for di temple and dis room nor far from di rooms wey dey di west side for di temple.

11For di rooms front, e get one passage wey bi like di one wey dey di nort side. E get di same measurement; di same design and na di same road, dem dey pass enter.

12One door dey under di rooms for di sout-side for di building and for di east end where di wall for start.

13Di man kon tell mi, “Dis two buildings wey face di open space so, dey holy. Na for inside dem, di priest wey dey enter God present, for dey chop di ofrin wey holy pass. Bikos di rooms dey holy, di priests go put di ofrin wey holy pass for der: di korn wey dem sakrifice for sin or for ofrin.

14Wen di priests enter di temple kom out and dem won go outside for di kourtyard, di holy klot wey dem wear take serve God, dem must leave am for dis rooms before dem komot. Dem must wear anoda klot before dem go-go where pipol gada dey wait dem.”

15Wen di man don measure inside di temple finish, e take mi go outside thru di east gate kon measure outside di aria.

16E measure di east side and na eight hundred and seventy-five fit.

17Den e measure di nort side, di

18sout-side and na eight hundred and seventy-five fit dem bi too.

19E still measure di west side and all of dem na di same lengt wey bi eight hundred and seventy-five fit.

20E measure dem from di four side. Di wall wey dey der, na to separate wetin dey holy from wetin nor dey holy and e long rish eight hundred and seventy-five fit and e still wide rish eight hundred and seventy-five fit too.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Ezekiel 42.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.