Ezekiel 35pcm

1God tell mi:

2“Man pikin, make yu tok against Edom.

3Tell Edom pipol, ‘God wey get pawa sey: “ ‘I bi una enemy! I go make una land empty.

4I go skata una town kon distroy una land, den una go know sey na mi bi God.

5“ ‘Na una bi di enemy wey dey worry and kill Israel pipol wen dem dey wahala and dat time na dia final ponishment for dia sin, dem dey face.

6So, as long as mi God wey get pawa bi di God wey nor dey die, una must die and una nor go fit eskape am. Just as una kill pipol, na so too dem go kill una.

7Edom pipol wey dey stay di hill, I go make una land empty and nobody go travel pass der again.

8Na dead body I go take kover di mountins and doz wey die for war, na dem I go use take kover di hills and valley.

9I go make una dey empty forever and nobody go stay una town again. Den una go know sey na mi bi God.

10“ ‘Una sey, “Judah and Israel land na awa own. Wi go take evritin wey dey here. Wi nor kare weda Oga God dey stay der!”

11So, as long as mi God wey get pawa bi di God wey nor dey die, I go ponish una akordin to how una vex rish, dey jealous and as una hate my pipol rish. My pipol go know sey I dey ponish una, bikos of wetin una do dem.

12Den una go know sey, mi God hear wen una sey, “Israel mountin don empty, so na wi get am naw.”

13I hear as una dey make mout and curse mi.

14God wey get pawa sey, I go make una land empty and di whole world go dey happy as una dey fall;

15just as una dey happy wen Israel skata; Israel land wey bi my own. Mount Seir pipol and all of una for Edom go die finish. Den evribody go know sey na mi bi God.’ ”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Ezekiel 35.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.