Ezekiel 32pcm

1Twelf years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di first day for di twelft mont, God kon tell mi.

2“Man pikin, go warn Egypt king. Tell am dis message wey I dey give yu: “ ‘Yu bi lion among di nashons, but na ordinary animal yu bi for sea; Yu dey skata di wota with yor leg kon make di river dirty.

3Wen many kountries gada, na der I go for katch yu with my net kon drag yu kom dry land.

4I go trow yu for groun make all di birds and animals for di world chop yu finish.

5I go spread yor rotin flesh for di mountins and valleys.

6I go pour yor blood from groun go rish on-top di mountin and blood go full di valley.

7Wen I don distroy yu, I go kover di sky kon komot di stars. Di sun go hide for di kloud back and di moon nor go shine again.

8I go off all di lite for heaven kon kover di world with darkness.’ ” Mi, God wey get pawa, don tok.

9“Di kountries wey yu neva hear of before, wen I tell dem how I take distroy yu, fear go katch dem.

10Wetin I do yu go make many kountries dey fear and dia kings go dey shake with fear bikos of yor kondishon. For di day wey yu go fall, all of dem go dey fear for dia own life.”

11God wey get pawa kon tell Egypt king sey, “Babilon king go kom fight yu.

12“I go let sojas from kountries wey get pawa, kill yor men for war. Dem go distroy all yor pipol and evritin wey dey make yu karry body up.

13I go distroy all yor animals near where wota dey and nobody or animals go disturb di wota again.

14Den I go make di wota kwayet again kon make di sea flow like oil.” Mi, God wey get pawa, don tok.

15“Wen I don make Egypt land empty and distroy evritin wey dey der, den una go know sey na mi bi God.

16Dis warnin wey I dey give dem naw so, go turn to sorrowful song Leta. Di wimen go sing di song as dem dey mourn for Egypt and en pipol.” Mi, God wey get pawa, don tok.

17For di Fifteent day for di first mont for di twelft year, God kon tell mi:

18“Man pikin, kry for Egypt pipol. Send dem with di oda kountries wey get pawa go where dead body dey.

19Tell dem sey, ‘Who una tink sey una fine pass? Una go-go where dead body dey kon follow wiked pipol stay der.’

20Egypt pipol go fall with doz wey die for war. Yes! One swod dey ready to kill all of dem.

21Pipol wey dey strong for dis life before dem die and doz wey fight for Egypt before, go welkom Egypt pipol wen dem kom where dead body dey. Dem go shaut: ‘Wiked pipol wey dem kill for war don kom relax for here!’

22“Assyria pipol dey der with all en sojas grave. All of dem die for war

23and dia grave dey for where deep pass. All Assyria sojas die for war and dia grave dey round en grave. But before wen dem dey alive, dem dey make pipol fear.

24“Elam dey der and all en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die go where dead body. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.

25Among doz wey don die, dem make somewhere for Elam and en pipol. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.

26“Meshak and Tubal dey der too and en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.

27Dem nor beri dem as dem bin dey beri pipol wey really fight and die for dia kountries; pipol wey dem beri with dia swod under dia head and dia shield for dia body. Dis pipol dey make pipol fear wen dem dey alive.

28“But naw, dem go win una and una go die go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.

29“Edom dey der with en kings and rulers. Dem bi sojas wey get pawa, but naw, dem don die kon go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.

30“All di prince for nort plus Sidon pipol dey der too. Even with all di pawa wey dey make pipol fear before, dem still die with shame kon go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.”

31God wey get pawa sey, “Wen Egypt king and en sojas go si doz wey dem kill for war, belle go sweet dem small.

32Aldo, na mi worry Egypt king wen e dey alive, so en and en sojas go die go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.” God wey get pawa don tok.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Ezekiel 32.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.