Ezekiel 30pcm

1God kon tell mi again,

2“Man pikin, go tell Egypt pipol wetin mi God wey get pawa dey tok. “Make yu shaut tok dis word sey: ‘Wahala day dey kom!’

3Di day wen God go take akshon, don near. For dat day, darkness and trobol go full di kountry.

4War go dey for Egypt and strong wahala go dey for Sudan. Dem go kill many pipol for Egypt. Di kountry go skata and e go dey empty.

5“All di sojas wey dem hire kom from Sudan, Libya, Lydia, Arabia, Put and even from among my own pipol, go die for dat war.”

6God sey, “From Migdol town for nort go rish Aswan town for sout, evribody wey dey guide Egypt, go die finish for di war. Di sojas wey dey make Egypt proud, dem go distroy all of dem.” Mi, God wey get pawa, don tok.

7“Na di land go empty pass for di world and en towns go skata finish.

8Wen I don put fire for Egypt and all di sojas wey dey guide am don die finish, den dem go know sey na mi bi God.

9“For dat same day afta I don distroy Egypt finish, I go send messenjas for ship go tell Ethiopia pipol sey wahala dey kom. Dem dey tink sey dem dey save, but naw, fear go katch dem.”

10God wey get pawa sey, “I go use Babilon king, Nebukadnezzar take kollect evritin wey Egypt get.

11En and en wiked sojas go kom skata di land. Dem go attack Egypt with swod and na dead body go full di land.

12I go turn River Nile to dry land kon make wiked pipol rule Egypt. Yes! Strenjas go skata di whole town. Mi, wey bi God, don tok.”

13God wey get pawa sey, “I go distroy and skata di juju wey dey Memfis. Nobody go ever rule Egypt again and I go make all di pipol fear.

14I go make di sout-side for Egypt empty kon put fire for Zoan town wey dey di nort. I go ponish Tebes wey bi di main town.

15Pelusium, Egypt town wey get all dia betta tins, I go make am feel as I dey vex rish. I go distroy di money wey Tebes town get.

16I go burn Egypt town and evribody for Pelusium go dey kry with pain. I go break Tebes wall rish groun kon kover di town with wota.

17Di yong men wey dey On and Pi-Beset town go die for war and dem go katch and karry di rest pipol go prison.

18Darkness go kover Tahpanhes town wen I break and end di pawa wey Egypt get, wey make dem dey make mout and karry body up. Kloud go kover Egypt and all di pipol wey dey inside. Den sojas go katch and karry all of dem go prison.

19Wen I don ponish Egypt like dis, dem go know sey na mi bi God.”

20For di elevent year afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di sevent day for di first mont, God kon tell mi sey:

21“Man pikin, I don break Egypt king hand. Nobody fit bandage am or do wetin go make am well or strong again and e nor go fit whole swod again.

22Naw, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘I bi Egypt pipol enemy. I go break di king two hand; both di one wey good and di one wey don break before, den en swod go fall for groun.

23I go skata Egypt pipol go difren place for di world.

24Den I go make Babilon king strong kon put my swod for en strong hand. But I go break Egypt king hand and e go kry kon die for en enemies front.’

25Yes! Na mi make am weak, so dat Babilon king go strong. Wen I give Babilon king my swod and e point am face Egypt, evribody go know sey na mi bi God.

26I go skata Egypt pipol for evriwhere for di world. Den, dem go know sey na mi bi Oga God.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Ezekiel 30.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.