Bible

Power Up

Your Services with User-Friendly Software

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Ezekiel 28

:
Nigerian - pcm
1 God tell mi.
2 “Man pikin, go tell Tyre king wetin mi God wey get pawa dey tell am: “Yu dey proud and yu dey sey yu bi god wey sidan for throne and sea dey round yu. Yu fit pritend sey yu bi god, but make yu know sey na human being yu bi and nor bi wetin yu tink.
3 Si, yu tink sey yu wise pass Daniel and nobody fit hide anytin from yu?
4 Yor wisdom and wetin yu know, don make yu get money, gold and silva.
5 Yu do betta business kon get plenty gain and naw, yu dey make mout kon dey karry body up, bikos of yor money!
6 “Naw, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘Bikos yu tink sey yu dey wise as god,
7 I go bring enemies kom attack yu. Dem go distroy yu and all di fine-fine tins wey yu don use yor wisdom take get, go skata.
8 Dem go beri yu for pit and yu go die yeye deat for inside sea.
9 Wen dem dey kom kill yu, yu go still tok sey yu bi god? By di time yu go si di pipol wey won kill yu, yu go know sey yu nor bi god, but na ordinary human being yu bi.
10 Yu go die like dog for strenjas hand. Mi, wey bi God, don tok.’
11 God tell mi again sey,
12 “Man pikin, kry for wetin won happen to Tyre king. Tell am wetin mi God wey get pawa dey tok: “Yu bi betta ezample to pipol before. Yes! Yu bin fine well-well and get sense.
13 Yu dey stay for Eden, God gardin. Dem kover yu with fine stones like rubis, diamonds, topaz, beryl, karnelian, jasper, safayas, emeralds and turkwoise. Na gold dem take make evritin about yu and dem make all dis tins for yu for di day wey God kreate yu.
14 I put one angel wey pipol dey fear, make e guide yu. Yu dey stay for my mountin wey dey holy and dey waka for stones wey dey inside fire.
15 Wen God first kreate yu, yu bin dey bihave well, until yu kon start to do bad tins.
16 Yu just dey busy dey buy and sell and dis tins kon make yu dey misbihave and kommit sin. So I ask yu make yu komot from my mountin wey dey holy and di angel wey dey guide yu, porshu yu komot from di stone wey dey inside fire.
17 Bikos yu fine, yu kon dey karry body up and dey bihave like fool. Na dis make mi skata yu for groun as warnin to all di oda kings.
18 As yu dey buy and sell, na so too yu dey do bad tins and naw, where una for dey woship God, nor dey klean again. So, I vex set fire for di town kon burn am rish groun. Evribody don si sey yu don turn to ashes.
19 Naw, fear dey katch all di kountries wey bin dey kom meet yu, bikos yor end don rish.”
20 God tell mi:
21 “Man pikin, make yu tok against Sidon town.
22 Tell di pipol for der wetin mi God wey get pawa dey tell dem: “Sidon pipol, I bi una enemy and pipol go praiz mi, bikos of wetin I go do una. Dem go know sey na mi bi God wen I don show as I holy rish and afta I ponish evribody wey dey stay Sidon.
23 I go send diziz kom meet una and una blood go flow for una street. Pipol go attack una from evry korna and una go die finish. Den una go know sey na mi bi God.”
24 God sey, “Di kountries wey surround and dey fight Israel pipol before, nor go fight dem again. Dat time dem go know sey na mi bi God wey get pawa.”
25 God wey get pawa sey, “I go bring Israel pipol kom back from di kountries wey I skata dem go, den all di kountries go know sey I dey holy. Israel pipol go stay for dia own land. Di land wey I give my savant Jakob.
26 Israel pipol go dey save as dem dey stay der. Dem go build house kon plant vine for der again, den I go ponish all dia neighbour wey ponish dem before. Den dem go know sey na mi bi God.”